As I waka behind the lady I take time observe the lady from behind… Osanobua! the front na joke compared to wetin she dey drag for her back, two massive ass cheeks wey dey shake like say dem fit roll comot from the tight elastic gown wey she bin wear. How Malay want make I take handle this one.
We stop for one door, she comot key from where I no know open the door. I follow her enter the tiny room. As we enter the room I take my eyes scan the room quickly, just one bed, an old arm chair and a table top refrigerator. The lady throw herself ontop the bed, me I just stand for the door side dey survey the room like one land agent until her voice bring me back to reality I hear her murmur something wey sound like “abeg you go do fast o”.
As I turn look her side I nearly shout, now now the lady don already comot all her cloth finish dey stretch wetin be like condom pack give me, the whole thing just be me like film. the speed my preek take begin dey grow again fear even me wey get the preek because na like this e take activate for the other lady wey suck my preek.
As I dey collect the condom from her our fingers touch, I nearly jump …… na then e dawn on me say since I don dey carry condom waka I never try bring am out wear am ontop my penis for fun make I even see as e dey be.
I just lost dey look the naked lady as she spread herself for bed, I wonder how she take comot all her clothes within seconds. No be say she fine or anything but I just dey look everything wey I don dey imagine for my whole life for my front. See live toto for my front, her pussy region black unlike her bleached skin and as she open her legs I see thick rugged meat unlike the one I dey see for oyibo blue film this one just rough get plenty flesh full am. Na as she hiss I get myself again,
“Oga wetin dey do you na”
I begin struggle to open the condom, she just snatch am from my hand viaaammm… she bring out the oily condom, come near me begin drag my trouser comot like say we don fight before. This one no even take am easy with me like the other one wey give me BJ.
My penis don already stiff, hard like rock and as she drag my trouser down to my thigh along with my boxers my hard odogwu just jump out, me sef shock as the thing take stand hard like London bridge between me and her.
“shuuu see the kind mighty preek you carry yet your friend dey price me nonsense” she shout as she begin wear the condom over my erect penis. At this point honestly I happy say she confirm say my penis big, maybe na why the other lady no gree swallow everything.
I wonder why Malay no tell her say na my first time make she take am easy with me, I reason am say make I tell maybe she go fit understand, another mind say make I just continue, anyhow she wan do am make she do am.
“You just dey do smeh smeh ……. you dey sick?” the lady asked angrily, probably she notice as my body just dey shake,
“Abeg na my first time” honestly I no know when those words drop from my mouth, I finally confess, my mumu bin dey frustrate her seriously and I just had to tell her before she go pursue me comot from her room.
“Oh oh JJC, you for just talk am since na, u just dey here dey do like ogbono” she talk with one kind smile wey I no know if na positive or negative.
My body temperature bin don suddenly rise, my heartbeat enter relay race mode, I just dey swallow enough saliva as possible to wet my throat, I come dey regret why I no drink that beer. As I tell her say na my first time e come be like say she come dey calm and nice begin dey talk to me gently.
She pull me on top of her on the bed, I just leave her make she dey in charge make I just submit to lead. She hold my penis guide am to her meaty pussy and within seconds I enter her, remain small I for clap for her as she disvirgin my innocent preek. I get the feeling say she bin dey wet because of how my penis slip enter but na later I realize say na because she wide like football pitch.
Even with the condom I feel one kind unsual sweet sensation wey run through my body, I remember the feeling, na the same thing I feel when that lady put my penis inside her mouth.
I close my eyes tight again, I no know wetin I bin dey do but I just dey follow her lead as she take her hand hold my waist dey move me back and forth gently, my penis bin dey go in and out of her. The entire process and movement be like stupid play but the sweetness I bin dey feel for my body just dey burst my head.
I bin wan go fast like I dey see for blue film but put hand for my belle use am stop me, she tell me say make I just dey go small small for a start, e remain small I for say yes ma.
I no even do reach 30seconds when that intense feeling I bin feel when that lady bin dey give BJ overtake my whole body again but omo this one high pass that one by far, my body stiff then I begin dey vibrate, jeezzz my first cum from real sex no be all those masturbation I dey do.
I no fit describe this particular feeling, my whole body begin dey shake as I shoot loads of cum inside the condom. Another round of shame hit me again say I cum too fast, e do me like say I still be virgin. I shock when she begin dey console me say naso first time dey be, she say she go run me bonanza that night but I go promise her say I go tell Malay make eim top her money and say anytime I come the brothel na only she I go dey march.
i just dey nod yes to everything wey she talk. Me and that lady run four more rounds, if my penis go down she go suck me till e go stand up again then we go continue dey fuck. she even set that her gigantic nyansh give me doggy position, but na she do almost all the work dey bounce her nyansh jam my preek, na that one almost ruin me.
I nearly cry as I cum from fucking her pussy from behind, the feeling no be here atall. By the time we run the fourth one aswear I don upgrade dey thrust deep and fast.
By then I don learn how to increase pace dey slam her toto with all my energy like say e get reward she promise me. Even though that time all my body don weak dey pain me, I just carry am for mind say I wan get am right….. e sweet me when I bin dey fuck her she come dey make sound small small like say she dey moan.
Omo that wan burst my head! If you see I apply pressure and energy dey pound her toto like say my success in life depend on my performance with her.
The lady sef bad gaaan, as I dey fuck her that fourth time with all my energy she grab my shoulder pinch me tight come raise herself up small begin lick my face and ear dey motivate me with yeye talk, she tell me how she want make I dey fuck, say my penis dey sweet her, no dirty talk she no open mouth and na all that thing wey make me nearly die ontop her matter.
Na Malay come knock the room door to confirm if I still dey alive, he say he don dey fear weda something don happen to me because he no expect say I go stay long like that. Omo when we reach house that night I just dey shout “toto sweet”, Malay say make I calm down say na when I fuck clean girl raw without condom I go confirm the real sweetness of toto.
Na after that day, I enter beast mode, I make sure say i visit that brothel almost every evening, dey collect fucking lessons from that lady and she sef take her time dey teach me well as far as say I bin dey pay her better money until I master the act very well. The day this lady comot mind ride my preek, na that day I resolve say I go dey fuck toto all my life.
When I dey sure say I don learn well, I begin explore every girl wey i bin don come across wey give me green light before…… everybody shock as I take change dey bring different girls everyday enter my room. Suddenly person wey dey always shy for woman matter just begin change woman like say na cloth. Even Malay sef shock, because I come begin do pass am. I change ladies sotey dem begin call me skirt. Say na anything wey dey inside skirt I dey carry.
Dem say when good person wan bad e dey bad pass bad, the remaining three years wey I spend for school, my body count rise like say I don dey fuck from birth, and as I finish school I carry the adventure come house continue dey sample girls around my area.
Especially all my mama apprentice for her shop, I fuck all of them one by one. But I make sure say my mama no find out and even most of the girls no know say I dey fuck their colleague, for all of them mind dem be my one and only.
Na around that time my yeye preek nearly put me for trouble, just few weeks before I go for my NYSC. I bin dey hear the rumour small small say e get one woman wey my papa bin dey kpansh, aswear I no first believe because that man too love my mama and if you see as my papa dey always do smeh smeh like person wey no fit kill ant, all that time I no know say the man dey active dey pound one popular fruit seller for our street.
Omo when I finally confirm am say na true, e pain me o… Na my babe see dem two, she come snap dem send the picture give me , I see as my old man grab mama Iyabo for waist dey smile like sheep. I just dey pity my mama because e no get as I wan take tell her say my papa dey cheat on her, I doubt if she go even believe me because the love she get for my papa long reach Burundi and besides I say make I observe bro code cover the man afterall me sef bin dey cheat on my babe.
Na then me sef I begin target Iyabo the woman daughter, I say if her mama dey chop my papa, me sef I go chop her daughter make everything balance.
Normally Iyabo na cheerful giver for area, she dey share her toto round but me I no gree collect, If dem bring money begin dash all the guys for my area wey don fuck Iyabo, almost every guy go collect money, na why I no dey reason her matter because I no dey like enter room wey plenty people don dey. if na for body Iyabo gather well well, wetin everybody take sabi her na say she no dey like wear pant and bra at all, so person go just dey see the shape of everything clear.
Iyabo get correct nyansh wey shape well and the thing dey shake like water inside Santana nylon, her bress mighty but from cloth you go still notice say the whole thing don fall finish. if to say children dey select bress wey dey go like suck, no pikin go pick Iyabo bress, because if that thing fall for pikin face e fit suffocate the pikin.. But na because of wetin my papa bin dey do I begin put eye for Iyabo.
Iyabo no even stress me at all, small talk wey me and her talk for her mama shade one evening wey I intentionally go buy fruit so that I go fit see her, she don already give me all the green light I need.
Two days after that evening wey I talk to her, person knock our gate for afternoon I go open am see Iyabo for gate, she say make I help her charge her phone say their light for house get issue. That afternoon she just wear one basketball jersey top and she no wear bra under as usual, I sight her full big breasts from the side of the top as she dey follow me talk. Even the small short she wear be like say na under size because her whole fat thigh just stand out.
Wetin funny me pass be say Iyabo dem dey live for the beginning of the street while our own house na one of the last houses for the street but this girl pass over fifteen houses wey get light come my house say make I charge phone for her, for my mind I say wehdone. I come begin reason if na to invite her inside or just collect the phone go charge am, I say make I try my luck, I remember say my papa dey house but I still tell myself say na the deal be that, afterall I want make the man know say I dey fuck the daughter of eim mistress.
I tell Iyabo say make she come use her hand plug the phone for light by herself, make she dey sure say e dey charge, Iyabo say no wahala follow me enter house. I carry her enter my room straight.
As we enter my room I just point where she go plug the phone for one corner of the room before I climb bed continue with the movie wey I bin dey watch for my laptop before she knock for gate. Aswear my head no dey the film, my eyes no gree comot from Iyabo body, as she bend nyansh dey plug the charger for socket, e get as she take bend wey I see the bulge and full shape of her pussy from the small tight short wey she wear as she no kukuma wear pant, my penis come alive straight.
As Iyabo plug the phone finish, I shock the way she just climb the bed like say na me and her dey share bed. But I maintain, I shift small make she see chance watch the film too. na only me know as my mind fly, her breasts no gree me focus, I just dey look am as e take dey rise and fall from the corner of her sleeveless top, small time my penis hard like iron, I try hard to control myself but omo my body no gree.
After a while Iyabo tell me say she wan drink water, as I get up climb down from the bed na eim my erect penis wey I bin dey hide since just shoot straight for her face, aswear the kind shame wey do me ehnn… as I quickly adjust my knicker make I hide my erection na eim Iyabo burst laugh, e be me like say make ground open make I enter, I just catwalk go kitchen go get the water.
Nothing I no beg my penis make e come down, the thing stand gidigba say no shaking. I tell myself say I no go kill myself, afterall na my preek stand I no kill person. naso I carry the glass of water go back to my room like that. Immediately I enter my room as Iyabo sight my erect penis, she begin laugh again, this time I no even send.
As she adjust herself to collect the glass of water from me she come take hand hold my penis for my boxers, I shock! She laugh tell me say make I do my worst…
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Norway/Netherland – Fill Norway/Netherland Form
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 1021 times!