April 12, 2025

Yeyegist: The Woman Wrapper (Chapter 1) [18+]

Home » Yeyegist: The Woman Wrapper (Chapter 1) [18+]

Yeyegist: The Woman Wrapper (Chapter 1) [18+]

For my area dem dey call me Skirt, “Skirt for the girls” the truth be say dem no just give me the name as nickname, I work hard to earn the name and I know say I deserve am.

The name fly everywhere sotey na the same name dem dey call me for school, na wetin dem dey call me for my street too. I set strong record everywhere wey guys still dey try to break till today.

E no get the kind shape, color, size or type of girl I never fuck for this country. The craziest thing na the kind risk I dey always take because of pussy.

Girls no dey hard me to get at all, small talk I go just talk she don land ontop my bed. My guys bin think say I dey use jazz, but I tell dem say na Pussy Grace, and I get sweet mouth die! in as much as I dey chook anyhow, I still give my penis terms and condition, na only mature girls wey don sabi preek I dey fuck, me I no dey like do small pikin things.

You no fit catch me say I dey run matter with underage, I no dey try am because me sef I get small sister and I go press anybody neck wey I catch near my sister and besides e no good make person dey take advantage of small pikin.

That time I no send anybody toto, I just dey knack like say na my calling. I don fuck cousins, knack sisters, fuck mama and daughter, do sugar mummy wey the woman son nearly use boys beat me, I no fit count the number of married women wey I don knack, thank God say their husband no catch me, I do two best friends wey one of them nearly baff the other one with acid because of my penis.

That day na small thing God take save me. I bin dey knack this two friends in peace dey run my calculation very well, if I knack Mary today I go kpansh Adenike the following day. Adenike know say me and Mary dey date but Mary no know say I dey chop her bestie for her back.

If both of them dey do all that their bestie thing for my front I go just dey laugh dem for my mind. Adenike sabi code very well, anytime she dey with Mary and I come around if you see as she go just bone like say me and her get issue.

E no get as Mary wan take suspect say something dey sup between two of us. infact Mary dey always tell me say Adenike no like me, say she get feeling say I dey cheat. But in the real sense na she I dey cheat on Mary with and we dey fuck like say tomorrow no dey.

You see women fear dem o! I know say Adenike dey always try poison Mary mind so that she go leave me, make she fit take full charge of my preek but me I bin just dey play along.

if Mary follow any man talk, na Adenike go first tell me say Mary and one man dey talk, when I confront Mary she go dey surprise how I take find out, all that time she no know say na her bestie dey sell her out.

E reach when my guys bin advice me say make I leave Adenike say my parole go soon cast but my strong head no gree me I no gree listen to my guys as dem warn me, na over confidence for kill me, because e just sure for me say Mary no go fit catch me.

And the fact say AdenIke sweet to fuck die, she dey give me mad styles and she dey always dey available person wey dey suck my penis like say na wetin she come this world come do. unlike Mary wey too dey do church and book but she dey give me money sha, but her sex life na zero.

Adenike na full package, she sabi fuck, she dey give me money, and she dey always wan dey around me sef, upon say I dey fuck both of dem, I still get other girls wey I bin dey fuck around too that period.

One hot afternoon like that, I dey lecture hall when Adenike send me message say she dey wait for me for my lodge, I send her message back sharp sharp say I think say she and Mary suppose go for one excursion, because Mary don already tell me say e get one excursion wey their class dey go.

Adenike reply me say she lie give dem say her belle dey pain her say make I dey come say she don miss me too much na why she use the opportunity say make she use am see me as Mary no go dey around.

Omo as I see her message everything wey the lecturer bin dey talk just dey pass one ear enter pass the second ear comot, as I dey look the lecturer wetin I dey see na Adenike as she dey ontop me dey ride my preek.

If I reason that one finish I go think the super blowjob Adenike dey give me, omo if na for head giving, that girl suppose don get international awards for best cock sucker but Mary no dey gree give head.

Remain small I for take excuse comot from the class but I reason am I no too dey trust all this ogbanje female lecturers, small thing dem don set test. I just hold myself say I go try dey till the end of the class.

As soon as the class dismiss I no even wait for anybody I just carry myself dey rush go back to my lodge. Even boys wey I dey like waka go home with bin dey ask me wetin dey happen because of the way I bin dey rush go house, I lie tell them say my belle dey turn me and I wan go home go use toilet.

As I reach my lodge I jam Adenike for one corner for the gate side where she just sit down ontop one block dey wait for me. She carry one two big shopping bag and e sure me die say na lunch she carry come. We first hug outside wey I kiss her lips before we enter my room.

As soon as we enter she first offload the things wey dey inside the bag, as I take guess, Adenike buy lunch with enough juice and yoghurt. We first settle down eat well, as we dey eat she dey gist me how she take pretend say she no dey feel fine wey she use skip the trip.

I drop message for my roommate tell am say make eim no come house say I get home match to play.

After we eat finish me and her enter kitchen begin dey wash plate dey gist, as i dey wash she dey rinse. Na one thing wey I take like Adenike she sabi make person happy, Mary fit sit down cross leg I go cook finish invite her to come eat still pack plates go wash, she go tell me say magi pass the food or the salt no guage well.

Na as we wash finish me and Adenike begin kiss inside the tiny kitchen. The kind energy she take dey chop my lips dey kiss me, me sef I know say she don miss me wella, no be my fault na her bestie wey no gree give us chance.

For weeks Mary just lock me dey gum me everywhere wey I no even see space do any outside fuck.

We break from the intense kiss wey we bin dey kiss, Adenike put her hand for my shoulder, push her chest front make her breasts press my chest come look me straight for eye like say e get wetin she want make I talk.

She lean closer, kiss my lips again we begin kiss slowly like say we be lovers, Adenike pull my head make my body brush her breasts well as I wrap my hand around her waist. She put her tongue inside my mouth dey give me one confirm French kiss, mesef no dull, I reciprocate accordingly.

Normally Adenike sabi this romance thing and she dey take her time do am make e enter my body well. My body shiver as she lick my ear, my penis begin rise inch by inch until the thing full inside my boxers.

As I bury my face for her neck begin lick from her neck up to her ear, her own vibration pass my own, she hold my head dey rub am like world cup, come whisper give me say make we go bed.

I notice say her breasts don swell finish and her nipple just point like say e wan bore hole for her top.

When she see say I never ready to carry her go bed, she just break the romance hold my hand begin lead me back to the room.

As we waka comot from the kitchen, I close the gap between us hold her waist from behind make sure say my erect penis press her nyansh well make she dey feel the kind erection she don give me.

As soon as we reach room, we turn face eachother begin another round of intense kiss, this time my hand explore her body, I play with her ear, grab her breasts dey squeeze am through her top, she moan inside my ear dey pant like person wey dem dey run pursue.

I come make Adenike lie on her back for the bed, na that time e come be like say dem give us millitary order make we comot cloth. If you see the speed wey both of us begin use comot cloth from our body.

As I dey fling boxers naso she sef dey uproot her blouse over her head, she quickly fold her skirt up reach her upper thighs exposing her thick fresh thighs. I help her open her legs wider make I for see enough space kneel ontop the bed between her legs.

As soon as we undress finish, I take my position between her thick thighs, my penis don already stretch over her like rod of moses, she take hand hold am with one kind alacrity like say na she tell God to give me penis, she come start to dey massage my preek gently.

I take time look Adenike from head down… kai the girl go well, God finish work for her body, from her round sizeable breasts with big black nipple, to her hips, her waist, her fat thighs, as I inspect her inner thighs I see say e get as she take shave her pussy hair, leave some hair to just hang around her shrine. She free my penis come hold my two hands pull me ontop her, we begin kiss again.

I kiss her slowly this time from her lips to her neck then down to her breasts, as I begin lick her nipple, the thing enter her for body she quickly wrap her legs around my waist. As I dey squeeze her right breast naso I dey suck the other one make I no go dey hear justice for left breast.

I move two fingers go visit her pussy for down, the moment I locate her pussy opening, e be like say I deep hand inside pot of warm honey, Adenike release one sound like cat wey dem hold for neck. I use my tongue tease her breasts make she relax body—she just dey moan, I finish with her breasts begin move down to her belle, I lick her navel small come continue down.

All her body just dey shake, she unlock her leg from my back spread her legs wide come raise her legs up hang am for my shoulders.

I bin wan give her head but as I remember say na from under hot sun she dey come and the place fit no go well, I change my mind put two fingers inside her wet pussy whine am inside her toto like say I dey find something wey I keep inside. Adenike just dey moan dey rub my head dey tell me how she don take miss me.

The more I dey move my finger inside her pussy the more her moaning increase volume, the head rubbing sef intensify and me too I increase my digital penetration.

She raise her hips up to meet my finger, this time her voice don loud full everywhere, her body begin tremble, her nyansh start to dey jump comot from the bed, she begin jerk, she stretch body come lock my hand between her thighs like say na fight we dey fight. her eyes open wide like say she see wetin she no suppose see.

Suddenly she just freeze dey look me dey do “oouuhh oouuhh ooouuuhh ooouuuhhh” like monkey na then I feel her hot cum trickle down from her pussy, soaking my fingers with pussy juice.

Adenike pull my head to her face, our lips jam and we begin kiss that kind aggressive intense kiss wey person no go see air breathe.

As we dey kiss naso she dey stroke my penis fast. Her hand soft like foam, and anytime she use her finger tease my penis tip with the pre-cum wey don settle for there, omo e dey do me like say I wan explode.

As we dey kiss she hold my penis, wrap her legs around my waist take am lock me again, I hold her hand as she hold my penis, I help her guide my penis enter her pussy. My preek enter her wet slippery toto one time.

Na that moment door burst open Mary march in with one other girl like that.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

Norway/NetherlandFill Norway/Netherland Form

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 2768 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics