January 24, 2025

Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 2] (18+)

Home » Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 2] (18+)

Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 2] (18+)

With the heavy sound the people wey dey sing for inside the church dey make, I dey sure say nobody fit hear the noise wey me and Amara dey create outside for the church car park dey do our own praise and worship. Na that one make me even increase the speed wey I take dey fuck Amara.

I begin knack her with the kind speed wey if to say fuck get officers like fuck safety the way road take get road safety, dem for don catch me bill me heavy fine, because I bin dey lash her with deep, fast and hard thrusts wey she just dey shout scatter everywhere with noise.

As she dey shout “oh yes…” naso she dey shout “fuck it……fuck it……fuck it……..fuck it” small time she go switch to “yea….yea…..yea…..yea…..yea”.

Na her ringtone and all the things she bin dey talk I take do motivation dey pipe her hard. I comot my hand from her hips, place am for her back take am press her down so that I go fit penetrate well dey slam her pussy from behind.

Na her nyansh quake give me joy pass, the way her big soft nyansh bin dey shake as I dey jam her from behind na eim off me pass.

I come dey wonder say shey no be this same person wey pastor just do deliverance for now now be this? Person wey all the prayer warriors for church put hand together pray ontop her. For my mind I say na three things fit don happen.

Na either the ogbanje spirit comot from her go wait for one corner dey wait, then as soon as they finish the deliverance the thing enter her back. Or, the whole thing wey she and the pastor do na acting, dem just follow script, including all the falling and rolling for ground.

I tell myself say if na acting omo na expensive scene oo and she suppose charge high cuz e sure me say she go don wound herself.

Or maybe the pastor no know say some of the demons go hide for her toto and nyansh because the kind perfection she take dey throw her nyansh dey collect my preek, e be me like say na another supernatural power dey behind am.

Just when I think say she go tire, Amara part her legs wider make I get enough room to penetrate deeper, her toto wey don already over wet sotey e bin dey spurt pussy cream as I dey fuck her, each thrust I wipe her she just dey wet more. For my mind I say if I no take time, my preek fit drown inside this girl pussy.

I begin doubt all the things the pastor bin talk say eim see say I get the promotion and all the affirmation, because I wonder why eim no see say the girl na fuckmando upon all the prayer wey dem do for her, and I wonder how dem go do deliverance for person finish now now, the next hour the person dey fuck preek like say tomorrow no dey.

As I dey reason all these things I lose focus but na Amara continue to dey fuck me go. The way she just dey bang her fat juicy nyansh for my preek nonstop, fear sef catch me, I begin reason things all over again.

So, I come church for vigil jam this very beautiful girl wey dem just do deliverance for say she bin get ogbanje spirit and about two hours later me and her dey fuck doggy for the car park of the church.

Amara fine well well and her body sharp too, how come she just give me her body like that say make I fuck like say na bonanza she dey run. Fear begin creep in small small. Honestly I bin no wan even reason the possible what ifs.

What if as she dey fuck me she dey transfer the ogbanje spirit give me, omo, at that point e no get wetin I fit do, I don already fuck her, wetin go happen go happen.

Na all these thoughts wey I take distract myself with no gree me release quick, wey be say Amara sef tire for my unyielding penis as we don fuck for long and I no gree cum.

She ease herself comot from my penis come turn quickly face me, hold my stiff penis begin stroke am gently, we kiss small before she kneel down face my erect gbola as e position for her front.

Amara stroke my big man come raise head look me ask me if I care for blowjob……. See me wey suppose dey fear Amara, if you see as I shaperly nod head like Agama, she smile, she first use her tongue tease the tip of my penis.

That thing sweet me ehnn, I fold her braid come hold am tight. She use tongue lick my penis go down to my balls, she put those ones inside her mouth suck am still go down lick my thighs, na that one off me pass because nobody don ever lick my thighs before.

Amara take the head of my penis inside her mouth, na only the head she put for mouth dey suck am she no swallow the other part she just hold my penis tight dey suck my dick cap dey stroke the remaining part of my preek as she dey suck the cap.

Na only God know wetin she take her tongue dey do wey my whole body bin dey do me like say dem connect live wire for my body. The girl head game too good, you go know say she be professional head giver.

Wetin surprise me na the way she just dey suck only my dick head, Amara make sure say she no pass the cap and if you see as she dey suck am like say her life dey ontop am.

Omo pleasure and pressure full my body at the same time— na me come dey moan like woman dey push her head make she take my whole penis inside her mouth, Amara no gree, she just focus on the head dey do that winchy thing with her tongue join as she dey suck my dick cap.

Na that time one yeye thought come hit me say what if the ogabnje spirit possess her she come bite my dick head chop am off…… For my head I say God abeg o, na for your house I dey.

The moment Amara push my whole dick inside her mouth, them no born my body well to hold the hot sperm wey I shoot out immediately, cum wey I release fit reach one full litre and the force e take shoot out the thing enter her throat straight, e get as she sef choke come begin cough.

As small small sperm bin dey comot naso I dey push her head dey press her head make she swallow my whole length. Amara just dey choke, saliva don full her whole chin dey trickle down her chest and breasts.

She lick all the cum from my penis, wetin shock me pass na say she swallow everything sam sam.

Other girls wey don give me head before immediately I cum inside their mouth dem go hold the thing for their mouth rush go baffroom go pour am but this girl swallow every drop before she stand up ask me if I get any piece of cloth wey she fit use clean herself.

I pull my trouser up, rush enter my car make I give her my handkerchief, as I enter inside my motor, Amara follow me enter for the front passenger seat, next thing she near me come pull my shirt, naso we begin another round of kiss again.

She carry hand put for the back of my head like say I wan run away dey suck my lips. I palm her breasts dey squeeze am like say the breasts don offend me before, I pinch her nipple the thing enter her for body.

I do small small unlock myself from her hold move my mouth from her lips down to her breasts. Choi! Her breasts soft for mouth like ehnnn……and over cuteness wan finish her nipple. Amara just dey rub my head as I dey tidy her bobby.

I quckly adjust the chair make we get enough room for wetin we wan do. She come climb ontop me. E get as she take lock my legs between her legs, the position make her open her legs wide.

I run one finger go down shift her pant, she still dey very wet and slippery and my own preek sef bin don dey hard again. amara ease herself up comot my penis from my boxer stroke am, she rub her pussy collect pussy juice for her palm take am rub my penis make e wet before she lower hersef ontop my big hard pole.

Amara no even waste time wey she begin dey bounce ontop me carry her hand wrap my head, press my face for her big breasts wey I nearly suffocate. She just dey jerk ontop me, I try to suck her breasts but the way she bin dey bounce no gree me.

I allow her to ride me hard and she sef no mercy for me at all, she just dey go hard and fast. By then my penis don hard finish and I don dey get this sensation like say I go soon release.

Amara sef don over wet but she still dey bounce ontop me. she increase the speed wey she take dey ride me sotey I begin fear say this girl go harm my preek if I no use my hand hold her nyansh and hips dey control her movement.

She grab my shoulder, throw her head back come dey jump ontop me fast fast even dey cry ontop. The whole motor just dey bounce and I dey sure say anybody wey dey outside go notice am say na fuck person dey fuck inside the car unless the car sef dey under special anointing.

I notice as her body begin shake, at this point she no fit even control her bouncing again, she just dey jerk ontop me. If not for say I know say na her orgasm dey near, I for don think say the ogbanje spirit don come again.

Amara hold me tight me sef I raise her nyansh up come begin slam her from under, until she make one kind sharp noise like person wey dem press for throat, na then I feel her orgasm as e baff my preek.

Na that time my coast clear, I press her hip down to my groin before I shoot my own load of cum inside her well well.— na then she come fall ontop me.

She just straddle herself ontop me for the front seat come rest her head for my chest like say she be baby, we dey like that for almost 20minutes before she clean up adjust her clothes begin go back inside church we no even talk anything to ourselves, na as she dey go I just tell her say I go call her later. Shame and guilty conscience no gree me enter church again until e reach almost time wey vigil dey close.

Na then I enter, I follow for closing prayer even though I know say my prayer fit no cross the ceiling. After prayer, pastor do announcement say make I see am after service along with a few other persons. Na then I first fear, my mind bin dey tell me abi the man see us when we dey fuck.

By the time I go meet pastor e come be say pastor just want make I pray and fast,, the man reassure me again say everything eim see go happen and make I go closer to God. Me wey don already lash one toto for God’s house.

No be like say I no believe the pastor oo, infact I bin want make eim revelation come through very well but omo that Amara deliverance and the kind matter we run outside just about an hour after her deliverance no give me strength to take the Pastor seriously. I just dey nod head dey say amen. I wonder why eim vision no reach to see say I fuck for eim church garage.

Before me and pastor finish our talk, church don already clear small, I find Amara I no see her, my guy dey inside my car dey wait for me because eim no carry eim own car come vigil.

As we dey drive home, I ask am if na eim tell pastor say I dey find promotion, my guy say no say eim no tell pastor anything. The guy come begin gist me say naso the pastor dey see things about people, say the man na strong man of God.

Me I no even talk anything again, no be me go follow church person drag talk about, na only if my promotion come through I go believe am. I no tell my guy say I collect confirm fuck for church when everybody bin dey pray.

As I reach house that morning, my whole body just dey weak me because no be small fuck me and Amara bin fuck and say I no even sleep for night. I turn garri, warm soup chop begin prepare for work. Na sleep I sleep throughout that day for work wey my colleagues sef surprise because I dey everly dey active for work.

Some of them even come dey use am tease me say I don go do night work, say I don go fuck. Omo na only me know wetin I take my whole night do.

Immediately after work I carry myself go house go sleep better sleep wey I no sleep throughout the other night.

Na around 7pm for evening I wake up since around 4pm wey I reach house begin sleep and na even the sound of my door bell wey wake me, sleep sef still full my eyes well.

I just drag myself go parlour like person wey get belle go open door. My eyes nearly roll comot from my face when I open door see Amara for my doorpost, the sleep wey dey my eyes vanish immediately. I no even know when I shout jesus!

How she take know my house? Because I dey very sure say I no tell her anything about my house and the only person wey even sabi my house for that church na my guy, apart from am, e no even get anybody wey I sabi again until me and Amara do wetin we bin do the previous night.

I look around if na my guy or person carry her come my place, I no see anybody with her. no be like say my eyes no look the huge ball of breast wey full her cleavage or the short gown wey she wear wey stop for her fat thick thighs, the gown set for her body very well as e project all her whole perfect shape out.

But at that moment that one no be my problem, na how she take know my house I bin wan know.

I ask her how she take locate my place, Amara just laugh one kind winch laugh tell me say “she just know”

Remain small I shout Just know keh! How? Na then e dawn on me say I don finally jam trouble!

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 568 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics