January 10, 2025

Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 1] (18+)

Home » Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 1] (18+)

Yeyegist: The Ogbanje [Chapter 1] (18+)

E no get wetin I no hear about this particular man of God, people just dey loud the man doings, dey talk as the man dey perform signs and wonders for people, dey do miracle everywhere.

Even my close padi sef confirm the man say no be whining, say the man legit. no be say I no be Christian o, but me I don comot hand from anything wey go make any pastor chop my one kobo, i dey see most of this church miracle like film trick, pure entertainment.

Wetin carry me finally go this man church na when our director for the factory where I dey work call meeting say eim wan promote two persons from my department to supervisor level by the end of the month.

Normally the promotion dey come with increased salary, brand new official car and apartment for our company estate.

Omo me wey dey form hard man say church na HK, na me carry my two legs run go this man of God church say make eim begin dey pray for me, make I follow for the two persons wey dem go pick among the seven of us wey be senior staff for my department. Naso I begin

E get one Sunday wey dem announce during service say we go get special night vigil programme for Wednesday.

My guy wey dey pray for eim visa process to click ginjah me say make we go for the night vigil say na there things dey happen pass onto say miracle dey fly there for night. Omo me wey no dey joke with my sleep, I first no gree o.

Make I go dey dance dey pray for time wey I suppose dey use sleep better sleep, even if I no sleep I for just invite Sharon my sweet olosho wey dey service my engine steady, but as I remember the promotion and how much I really want make the promotion reach me, I just make up my mind wear my thick cardigan, carry my bible begin go church for vigil.

When I reach church that night my guy shock as e see me say I later come, because eim don already think say I no go ever come. Omo everywhere choke like say na normal day service, I just dey look everybody say so all this people like this no like sleep.

I dey vigil dey fight sleep, because e come be like say one demon dey one corner dey blow me fresh breeze make I sleep off, but the only thing wey no gree me sleep na the fine fine girls wey full the night vigil.

If you see as fine girls just yapa everywhere, me wey sabi sleep yakata I say make I no go open mouth begin dey snore come pour saliva destroy my steeze, I just dey force myself to stay awake dey battle with sleep. If the sleep come with full force I go begin dey inspect all the ass wey scatter everywhere, because na for far back I sit.

He come be like say dem select girls with big ikebe come vigil that night because na soso mighty nyansh I just dey sight, I come dey imagine the softness and how the thing go dey bounce if e dey collect preek.

Small time I go remember say na church I dey ooo, I go whisper lord’s prayer beg for forgiveness of sin before I go continue to dey examine the nyansh, aswear I no fit help myself. I sure say prayer wey I pray that night no fit pass the ceiling because e reach when I imagine sotey my penis begin stand erect.

The Man of God bin dey do deliverance for one fine girl like that, dem say the girl na ogbanje, I no know if na she or na the spirit inside her just dey make noise like say person dey suck her kpekus, and naso she dey fall for ground stand up still dey turn 360 everywhere.

Church attendant say she be student for university, say dem initiate her when she bin dey secondary school. Wetin enter my eye pass for the girl matter na her cute shape and the way her big fat ass dey shake as she dey move around, especially when the pastor begin fire prayer ontop her.

True true the girl set die with wide hips and full fat nyansh come get one kind huge bress, I no too see her face at first but from the small I see omo the girl face fine. For my mind I say make dem give me this one, I go use preek comot ogabnje spirit from her body asap.

Everything the pastor and the girl bin dey do just dey do me like washing and setting. No be like say I no get faith oo…. All this things just dey hard me to believe.

E reach when the demon wey dey whine me with sleep overpower me finish, mesef I kukuma surrender give am say I don tire to hold the sleep.

Before I finally adjust myself well for chair close eye sleep, I first look my padi, I see as my guy kneel down dey speak in tongues. for my mind I say that one na eim business, after eim finish he go still go fuck person daughter wey eim camp for house for over two weeks dey fuck steady in the name of serious relationship.

Sleep carry me go far and na that day me sef confirm say if you wan dream better dream try dey sleep for church.

By the time I wake up, pastor don run the deliverance for the girl with ogbanje spirit finish, e no hard me to sight her where she dey waka up and down for one side of the church auditorium dey pray, na her nyansh wey set like question mark even help me recognize her fast fast, as she dey waka dey vibrate dey pray, naso her body too dey shake.

Her body go well and I just dey imagine wetin ogbanje spirit find enter this kind fine girl. The spirit sef get eye for better thing because if you see her bress and how e take full her whole chest, I just dey reason the things I go do if I get the opportunity to sample her.

Na the kind bad thing I dey reason inside church when pastor begin talk say e get person for the congregation wey come because eim want promotion, say the person na senior staff but eim dey find promotion to supervisor level, say make the person step out.

E just be me like say my guy and the pastor dey run nollywood for me. I look my guy with one kind eye to know if na eim give the pastor my gist, my guy tell me say make I rush go front go meet the pastor make the man pray for me.

I dey always hear of all this pastor wey dey see things, but na the first time I dey experience am real life.

Omo as I step outside if you see as everybody just dey look me, thank God say I dress well that night. I just dey fear make eim no try that their prayer stunt wey dey make people act drama because me I no ready to dey roll for ground for the front of all the fine girls wey dey there.

As I dey come out to the front of the auditorium, naso the pastor begin run hype for me say eim dey see greatness and elevation around me, nothing the man no use whine me, I just dey claim am say if this thing work ehnn I go do this man well. When the man put hand for my head begin pray, I first fear say I fit fall down begin do like that ogbanje girl, but thank God say nothing happen.

After one serious energetic prayer, the pastor say make I go sit down say everything don already happen. Me I just waka go outside go collect better fresh breeze.

I waka reach the church garage go sit ontop my motor dey reason everything wey happen inside, I know say my other colleagues sef go don go places to get this promotion too, but true true if dem wan check am I suppose follow for the promotion.

If not for anything, at least na me be the most senior staff and na me dey reach target pass, but I no trust all these white men, our director fit don already get favorite among us wey eim go give the promotion to, na why I need the prayers. Na then I come begin wonder how this pastor take know about my promotion, me I no dey fall easily for all this church thing o.

I say if we dismiss I go hold my guy interrogate am well.

I still dey think all this things when I sight the ogbanje spirit girl as she comot from the church auditorium waka come the garage side, as I see her hand for her ear e be like say she dey make call, call for that kind mid night.

I check her out again, the girl fine no be small I say make I follow her reason even if na number I go collect, afterall dem don collect the ogbanje spirit from her.

As she finish the call wan begin enter back, I rush stop her say I see her inside church say I bin dey find how to talk to her, she just smile say her name na Amara. I just dey struggle to control my eyes, wey just dey fly from her large breast to her fine face.

I tell her make she give me her number so that she go fit go back, she laugh come ask me say how come I no fear her say dem just comot demon from her body- sharp guy like me, I tell her say demon or no demon say na Amara I want.

She just laugh begin call her number give me, mesef give her my own. if you see the kind flirty smile this girl just dey give me for my mind I say you sure say the demon no forget eim handbag inside her.

She ask me wetin I dey do outside, I tell her say I just wan cool off, she come smile call me latest supervisor. Omo na that one I rush shout amen. Na then she come leave me go back inside me I waka go back to my car.

Aswear e no reach 5 minutes wey she comot wey message enter my phone from  Amara, she just send me one short direct message wey she ask me if I wan fuck her! Say she fit come meet me outside. Naso my mouth open waaaa as I read the message 50 times per minute, I say shuuuuuuu this kind demon na olosho demon ooo. I look everywhere, the whole place calm kpa.

I remember that her fat ass and gigantic bress again, na for inside car I fit fuck her because na for corner I park my car keep.

That moment my head blank, I totally forget say na church I dey, I just dey try figure out where I go fit stage her make I lash her make I no miss the opportunity. I bin still dey reason am when I see her again as she comot from the church auditorium come outside dey waka come my side. I say yes.

Charlie you don enter one chance. As I jump down from my car boot wey I sit down waka go meet her, Amara just pull my shirt drag me go the dark corner for the back of my motor begin kiss me.

Omo this girl sabi kiss fire, her lip and tongue just dey do magic dey roll and twist inside my mouth, she stretch up to meet my height come pull my head down so that our lips fit tangle well together.

She just dey lick my ear and neck, I hold her hips tight come put the second hand for the back of her head they kiss her. her lips soft and e just dey swallow my own like kpomo, we kiss, dey explore eachother mouth like serious lovers wey don dey date for very long time.

As I dey kiss her naso my hands begin patrol round her body, she sef just dey run her hands for my whole body too. Finally I carry my hand go her nyansh press am small, kai! Her ass over soft, e be like foam.

I no even send say na church premises we dey, I no even remember say left over ogbanje fit dey her body, I just dey kiss her.

My hand move until I reach her bress, I make sure say I intensify the kiss well before I grab her bress, she no even bother, she just dey rub my head. She begin comot the button for her gown wey she wear. As she comot the first three buttons, I see better sharp breast, my head reset immediately.

When she carry hand go my preek side, she feel am say my penis don already hard well well she just chuckle whisper inside my ear say I don already hard for her and say she sef don wet for me. She stroke my dick from my trouser, I know say she dey try feel the length.

I just unbuckle my belt pull my trouser and underwear together make she fit touch the real thing. Amara lick her palms, make sure say she wet am well before she come use her wet palm hold my preek, my legs shake as she begin stroke my penis.

I intensify the kiss dey grab her nyansh, squeeze her bress and her hair until she just turn, serve me her nyansh, she hold the boot of my car like say she wan open am, I position myself behind her, she fold her gown up come pull her tight and panties down together.

The sight of her nyansh off me, if to say na bag, dem fit hide a whole pikin inside am as e big come round. Thank God for cloth o, if not wetin some girls go dey drag for road dey waka ehnn. I first use finger dey trace her toto, I never even reach the main junction, my hand don already wet finish she don leak wey her whole inner thighs don soak. By the time my finger reach her pussy na mop I for use drain the kind wetness she don pack full there.

The wetness of her toto just make my preek enter her pussy one time as I push my penis inside her, Amara no even waste time she begin use her nyansh dey jam my preek wam wam wam.

I say which kind horny marine spirit be this one, as she dey jam me, I first give her free hand make she do her thing, until when I notice say she don dey tire dey slow down, I grab her for waist with my two hands begin bang her my own.

Na my own make her begin moan dey say things wey na only she understand. As her soft nyansh dey bounce back dey knack my waist, naso me sef dey pound her more. she begin beg me say make I go faster, me wey no dey carry last for knack command I use all the strength wey I for use pray smash this girl pussy, she just hold the car dey howl like dog.

The noise she make remind me of the kind noise wey she bin dey make when the pastor dey run her deliverance.

I say omo this demon don run this pastor street, the thing just pack well for one side of her body, the whole deliverance no touch am at all, the thing dey inside her dey enjoy my preek.

The kind fuck I smash Amara ehnn, only few girls fit withstand the fast, deep thrusts I pump her that night.

Girl wey carry herself come say she want make I fuck her, I fuck her sotey I nearly fuck hair finish for her toto, she just dey shout raise voice they make all the crazy sound with each hard stroke wey I pipe her, me sef I begin fear say church security fit hear us.

As she raise her bra up make I see chance touch her bress, omo I grab her bress squeeze her nipple like say I wan extract milk.

I dey fuck Amara naso her pussy dey water water add, I say kai na me gain pass for this vigil. small time dem begin sing praise and worship for inside church, the sound just bury all the noise wey she dey make.

I say wehdone, that one give me more motivation because I don dey fear say she bin dey make too much noise, I position well come begin give her my best shots.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 372 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics