Ebo matter hook me for neck that year, to even think say i sleep for police station because of that small girl, the funny thing be say na me carry my hand go find wahala put ontop my head. Ebo na my neighbor younger sister wey eim carry come from village to come write jamb exam for town and learn handwork too.
As her brother Donatus be my very close padi and neighbor, Donatus no even mind say Ebo dey free with me and me sef bin dey act as big brother to her.
Most weekends if she dey free she go come my apartment come clean the place even wash my clothes, Ebo just dey do younger sister duties for me and I dey buy her things, still dey dash her money well well.
Na my babe Chichi wey bin no too like Ebo because Ebo na 19 yr old girl wey carry body of 28yrs old and she fine well join.
My babe bin fear say I go chop the girl but honestly me I no reason all those things that time, afterall I bin dey like her elder brother.
Chichi no just dey comfortable with how me and Ebo dey relate, e even get when she even warn the girl say make she dey dress cover body if she dey come my apartment. Honestly that time me sef I never notice am say the girl dey open body.
No be say I no like woman but na just the way I don take the girl like my sister since Donatus carry her come.
Na me even suggest say make her brother find her one private lesson teacher wey go dey teach her so that she go pick up fast before the exam reach, and na me still arrange Julius one young fresh graduate for our parish make eim come house dey teach Ebo.
The arrangement be say na for weekends Julius go dey come teach her and na for outside dem go dey do the lesson for the balcony of Donatus flat. No be say we no trust Julius but you no fit use monkey secure banana and Ebo set well with one kind body wey normally person go wan sample.
So e get one Saturday afternoon wey I go pick waybill from one courier office, I say make I touch house small chop food and rest since my boys dey store and I dey always like give dem free hand on Saturdays. I no even drive enter compound because I no bin plan to stay very long at all.
I bin dey waka go my apartment when my eye just go Donatus flat, I see the whiteboard, plastic chairs and table wey Ebo and Julius dey use for her lesson, but I no see anybody there. Na as I stretch neck look well I come see Julius shoe for doormot.
Omo my head spark, which day Julius begin enter the house, we warn this boy make eim no enter the house say eim business na for that balcony.
My body no gree me ignore dem waka pass, naso I waka reach the door, I no even knock I just open door enter. The kind fuck wey Julius and Ebo bin dey fuck no even gree dem notice say I don enter.
Julius stand put for Ebo back dey fire Ebo pussy from behind with one kind fast deep thrust wey me sef shock say so this guy wey dey do holy holy fit fuck hard like this? Ebo just dey moan as she dey throw her nyansh back dey collect Julius penis.
E fit even be the tatatata sound as Julius body dey collide with her nyansh wey no gree dem hear me. even the position wey Ebo dey mad me, e get as she arc her back come raise her nyansh up and as Julius dey bang her ass naso e dey shake yokoyoko.
When I finally get myself from the shock wey hold me, if you see shout wey I shout, Julius pull eim preek from her pussy, jump go the back of chair go hide, Ebo shout run go one corner as she no wear anything dey cry dey beg me, I no know when I comot my belt begin flog knack comot from Julius body, two of us run round the parlour till eim see way run comot from the apartment with only eim singlet and trouser.
Eim leave eim shirt, shoe and teaching material for the house. I bin first hold am as evidence but omo Ebo beg me ehnnnn….. if u see as she kneel down dey hold my leg dey cry dey beg me say make I no tell her brother.
Na so I die the matter because I know wetin Donatus for do she and Julius if to say I tell am. But I warn her seriously say if I catcher her again I go tell her brother straight. Then I later call Julius tell am make eim tell Donatus say eim no dey teach Ebo again say eim get new engagements to attend to.
Aswear after that day, the way I take dey look Ebo change, that scene that day just dey play for my head everytime. I bin dey wonder how Ebo sabi fuck like that? Person wey arc as she do that day dey collect hot doggy like pornstar no start to dey fuck new.
Besides I begin dey notice her body too, no wonder my babe no just like make I dey relate with her. If you see her you go think say na full blown woman, her big round nyansh hang like say dem use invisible pole raise am, with her wide hip, her bress sef over ripe come occupy her whole chest and e still dey solid and pointed. Sometimes if she dey outside I go just dey observe her, but I still respect myself well.
From that day Ebo sef come dey fear me because I hold her secret and me sef com dey chook eye for her matter dey monitor her well. Until one February 14, Valentine’s day, that Sunday morning Ebo come clean my apartment, she tidy up the whole place do full sanitation because my babe bin don travel back to school that time.
When she finish she tell me say na her Valentine’s gift to me be that, I just laugh promise her say later that evening I go carry her buy her something.
Make I talk true as she dey clean my apartment the kind small short gown wey she wear, the thing free for her body but I dey see as her nyansh just dey shake free inside and she no wear bra. Remain small I bin wan try something that morning but na God and self control hold me.
I no concentrate at all I just dey imagine one or two.
Later that evening I bin dey one kind happy mood like dat so I carry Ebo comot, we first buy suya for one suya stand, then we go one joint buy pepper soup and juice still buy her brother own join, then I carry her go one mall where I buy her perfume, soap, cream and other items. Ebo happy well well and me sef i like am as I take make her happy, afterall she dey try for me well.
As we reach compound e com be say Donatus and eim babe never return from their own Valentine flexing so Ebo come my side say she go dey my place till her brother come back.
I leave her parlor, first go my room go call Chichi for phone before I enter baffroom say make I pour water for body small, as I dey baff na eim I notice say person enter the baffroom but soap full my face so no fit open my eyes make e no pepper me.
I know say no be my babe because I bin don talk to her and her roommate for phone before I enter baffroom so I know say she still dey school… the next thing I know person hand begin rub my chest, If to say I no know say na Ebo I for scream, but i don already scent her hair oil because she dey always use am steady and e get strong scent.
I just continue to fake like say I no know the person, dey wave hand dey ask “who is it” until my hand brush touch her naked breasts, ahhh! Naked breasts! Before I go say choi this girl grab my preek hold am begin dey stroke am gently, the thing enter my body vuuuum.
I try to open my eyes but the soap no gree me, honestly I bin wan touch the breasts again but as I dey wave hand I no feel anything for my front but she still dey stroke my penis.
Na when I force myself open my eyes I see say she don kneel down for my front dey stroke my penis with two hands like say I be her mate, I wan stop her but over sweetness no gree me.
Ebo first use tongue lick the cap of my dick, aswear that single act throw me overboard before she come put my rock hard preek inside her mouth, omo I wan burst, her mouth no too different from wet toto, she begin dey move her head back and forth dey suck my meat slowly.
Ebo sabi this blowjob thing die, see me see paradise. This small pikin give me senior blowjob wey my leg begin shake, a whole son of man begin groan dey vibrate. I murmur tell her say I wan cum, she no even stop she just continue dey suck me until I release thick cum inside her throat.
E sure me say she swallow am because she no even stop to suck me, Ebo lick my sperm finish continue to dey suck me until my penis hard again.
sharp sharp I position her make she hold the toilet seat, this time the soap no dey even pepper me again so I observe the ass wey I don dey admire since, i set her nyansh well, she sef give me another bad arc as she take give Julius that day, I first slide one finger inside her pussy I see say she don wet but she no too wet as I want her.
I first take two fingers find her clit, play with am small before I pour spit for my palm rub am for my penis head make e wet, I pour another spit again, this one I use am rub her toto make everywhere dey slippery, Ebo drag my preek, she first take am rub around her toto before she push am inside her wet pussy. Me I grab her bress from behind make I balance well begin thrust in and out.
Small time Ebo begin dey moan as she bin dey do that day with Julius but I make sure say she no loud am as night bin don reach and everywhere dey quiet, make other neighbors no go notice something.
But everly she still do small werey, me I just dey squeeze her round voluptuous breast like say I wan deflate am, dey fuck her pussy go. After some time we change position, afterall dem say change is the most constant thing.
I sit down ontop the toilet seat she come face me open her leg wide finish sit ontop my penis, if you see the kind fast ride Ebo ride me, fear catch me say this girl go bend my penis. I first take time admire her breasts as e dey fly and sway as she dey bounce ontop my preek, the thing give me one kind inner joy.
Small time I grab her left bress put inside my mouth, I know say that one off her as she take two hand hold my head tight come intensify the bouncing, e reach when she begin make loud noise but I quickly take hand cover her mouth.
Both of us freeze as e be like say we hear sound outside for the backyard, I grab Ebo waist hold am make she stop.
After few seconds she just continue dey bounce ontop me like say she no send untill she begin vibrate dey shake, Ebo squirt ontop my leg dey make one kind sound like bush animal, the thing enter me for body, naso I jerk her up, pin her back for wall, she sef wrap her leg for my waist.
I hold her legs open am well, na there I finish work fuck her toto, she just dey bite my neck and ear dey whisper wetin I no understand inside my ear as I fuck her deep fast strokes wey hit well reach her end.
Na then we hear the sound of motor wey drive enter compound, I drop Ebo down asap, she rush go my parlor carry her cloth open door comot, I know say na backdoor she go take enter their apartment and she go don clean up and dress before Donatus go park motor finish lock am and eim even carry eim babe come back.
I no go lie Ebo sweet die and she sabi fuck well well. Throughout that night, I no even sleep I just dey wonder how long she go don dey fuck wey she sabi fuck like that, I remember Julius wey I flog…….. My conscience prick me because I no see wetin I take different from Julius.
After that day the kind shame wey catch me ehnn I no fit face Ebo, and Ebo sef come dey avoid me too like say we fight. Even when my babe come back she notice am but I lie tell her say I catch the girl with another guy because na only my babe I bin tell about that Julius matter.
E no reach one week and some days after that day wey me and Ebo scrub wey Donatus carry police come my shop come arrest me one afternoon. Na when I reach station dem give me full gist say I give Ebo belle com give her concortion to comot the belle and say she dey hospital because the abortion no go well. The thing just be me like film aswear I think say na play until I hear the shocker say na one month pregnancy!!! One month kee! Person wey me and am just knack few days ago.
Nothing I talk wey make sense to anybody since I confess say true true we knack but say na just few days ago.
Donatus vex ehnn, no name the guy no call me, I just dey beg am, I tell my people make dem follow help me beg am say na devil. Na for inside cell I reason my life one million times, see as one day fuck with one small pikin mess me up.
Ebo set me up big time, so that time wey we knack she don already get belle dey find person wey she go put am ontop.
I dey police cell for 2 good weeks all that time Ebo sef dey hospital, the news fly everywhere like say na better thing, my babe breakup with me shap shap when I still dey cell.
Na one nurse for our area wey hear the matter come report give police say Ebo and one boy like that come ask whether she dey comot belle but she tell dem say she no dey do am say that day dem dey her shop dey quarrel, say na the boy get the belle say no be me.
After that expose police com mount pressure for Ebo na then she come talk true say no be me get the belle and say I no give her anything drink. Them later trace the boy but the boy don already japa. If to say Donatus get power eim for want make dem no release me but finally I comot after 2weeks.
I don already cast for the whole area, even for shop some people hear the gist, as I comot from cell I just carry myself comot from that house relocate go another far place, atleast I fit manage shop disgrace.
Nothing I no beg my babe, she no gree come back say she bin warn me about the girl and say if to say na only knack she for forgive me but the kind disgrace wey follow join say I end up for cell because of that small girl toto.
I beg her o but she no gree say she don move on, you know women, before you look left and right dem don jump enter another relationship. I later hear say Donatus return Ebo back go village immediately after she comot from hospital.
Naso few minutes knack almost wreck my life.
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 19226 times!