My mind tell me say make I begin shout if not na my dead body go comot from that house, but even the strength to shout no dey.
No be like say I never fuck more than one person at a time o, me wey be chairman for that side, normally if I dey carry ashawo na two I dey like carry on a very good night, me wey don spoil finish, only one no dey give me joy, if I dey fuck one I dey like to dey look the other one knowing say I go still climb am, the thing dey motivate me aswear.
Besides some of this ashawo sef dey misbehave, small knack dem don dey cry say their toto dey pepper dem, ordinary 5 minutes knack dem go begin beg you say make you go easy— I no blame some of dem sha wetin ashawo punani dey see on a daily no be wetin ordinary person fit stand, na why me I dey like carry two, as one dey rest the other one go dey collect.
But this situation dey very different, apart from say I no prepare for this particular fuck, na dem dey in-charge, fuck wey gun dey involved, the women no be my spec at all, infact their weight sef don finish me.
As the third one dey ontop me dey ride me with her water water nyansh, I just dey pray make I release. Imagine that kind moment when na you dey force yourself to release and the thing no even gree come, naso my penis just stand kakaraka inside her toto.
But the thing bin dey pain me like ehn, I manage open mouth beg her say I wan piss she say make I piss inside her, I hear as the other women burst laugh.
I take style look her face make I even see as she dey enjoy wetin she dey do, omo this woman just close her eyes tight dey feel herself. Say her breast huge na understatement, breast wey long pass belle remain small e reach her pussy.
E get when I come tell myself say e better to die in the act than to die a coward, aswear I no fit talk where that kind energy come from that moment, I just grab the flesh for her waist, raise her up small come begin fuck her from under, she sef assist me raise hersef up small, the thing come ease my leg.
As I dey jam her the only sound I dey hear na my body as e dey slam her nyansh from under, the other women sef shock dem begin clap.
If you see as the mighty breast just dey fly like say e go disconnect from her chest. Small time she come kneel down well, spread her legs wey be say my legs come dey between her, that position come make her pussy open mouth well well.
I fire this woman ehnn, she begin moan dey sound like say she dey sing, me sef know say anything wey make me stop my life no go be the same she fit shoot me but my eyes don already dey turn me, I say all die na die.
I no know whether na because say I don dey near death o, because I begin dey see faces of some of my relatives wey don die just dey flash for my front, still I no stop, wetin bring me back na when she begin shake like say convulsion hold am the next thing she release waaaaa full my whole body.
She come fall ontop me with her full weight dey laugh, me I just dey wonder where that vex power come from and I no still release ontop everything. I dey hear as the other women dey hail her, that time I don already off, I no even feel the woman weight ontop me.
After some time she get up, come rub my penis as the mumu thing still hard small based on say I never release, evil penis wey wan kill me.
I listen as dem dey praise her say na she enjoy me pass, but true true me sef no know the kind avatar mode wey I enter fuck her like that.
One of them come even dey para say she too wan cum her own cum but the other one warn her say I don overweak say I fit from there die, for where I lie down put like firewood I just dey pray for the one wey talk that thing.
The one wey I just fuck finish even suggest say make dem keep me make I rest small say she go like make I fuck her like that again, na eim the one wey dey like their oga say she wan begin comot say make dem free me.
I no know wetin time be then but I know say time don go well well, the one wey still wan cum her own cum just bend down begin rub my preek wey don go down but e never shrink fully.
From my small half eye wey I manage open I notice say na that one wey try to fuck me wey my penis no gree stand for, as she dey rub am, cum wey I no cum as I fuck the other one finish just shoot out, I know say wetin come out no pass two drops, because nothing dey my body again, the woman just hiss get up waka go.
I dey hear as them dey talk, I no know if na me dey die or na dem dey whisper, na like that I pass out. I wakeup see myself for the backseat of my keke, every part of my body bin dey pain me like say I go carry block especially my penis.
Na that one worse pass, I struggle look the small clock wey I fix for the keke dashboard. 5:20am father lord! I look the apartment everywhere just dark, e be like say nobody dey the house. I look the road everywhere clear, so na for here I sleep.
How I take ride the keke reach my house that morning na only God sabi.
Questions just full my head, who those women be? Where dem later go that night? Na just rape dem rape me abi na ritual? Make e no be say dem don use me renew their juju. I no just understand and I no fit tell anybody because e get as e be and honestly shame bin dey catch me to talk am.
After some weeks I gather mind go meet one pastor wey I know say no sabi me at all, I tell am the whole story. As usual the pastor do deliverance pray for me, still prescribe bible verses wey I go read and fasting wey I go do but fear no still leave my body.
Fastforward to weeks ago one early morning as I dey rotate with my keke, I see crowd gather for one popular junction for town, police even dey there I say make mesef stop look wetin dey occur.
I ask person around, the guy say dem catch thieves wey dey disturb the area, me wey dey like beat thief I squeeze myself pass through the crowd reach the front, immediately I see their faces I recognize them sharp sharp, even though na for night under red light dem do me that thing.
I still sabi dem well, na two of the women wey rob me rape me about 5 months ago sit down for ground with two other men, dem don use beating redesign their face.
The whole even of that night just flash for my mind especially as I see the one wey I take my last strength for this life fuck.
I use vex rush them begin beat dem, people sef come rush hold me even police, I tell them say dem don rob before say the women dey three but I no tell dem the other part of the story, police confirm say one escape but dem dey find am. The women no even recognize me sef.
Omo na that time the thing vex me enter body, so na rape this women rape me just like that, a whole me Jalingo, this women just yeye me.
Since then anytime I hear guys dey joke say dem go like make woman rape them or say e no dey possible make woman rape man, I go just laugh for my mind. Just dey pray say make you no jam.
The End
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 9144 times!