September 16, 2024


YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 4) [18+] {PIDGIN}

 

Home » YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 4) [18+] {PIDGIN}

YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 4) [18+] {PIDGIN}

At I bin first think say na Somto set me up make my wife catch me, but when I reason am again say I just see my wife kiss another man for hotel for night, na then e clear for my eyes say this one no be setup. As I take shout Dabota naso she sef shout my name, we just shout am together like say person press our play button. 

My wife wey tell me for phone say she don chop finish climb bed to sleep, na eim I jam for hotel with another man, she sef shock as she see me because I don already tell her too say I no go fit enter lagos that night. If you see the kind sweat wey I begin sweat instantly upon the mighty AC wey dey the hotel reception, you go think say person pour me water. 

Before I even get mouth talk anything, Dabota change everything begin play mind game with me, she start to dey para say wetin I dey do for the hotel with another woman, aswear e remain small I for beat wetin no good for her body if not for say people wey dey around hold me. The big man wey she dey with just confuse dey ask wetin dey sup, na that one my hand touch small before eim later run comot.

Na that day I see say the werey I marry as wife no get shame at all, Dabota come carry her vex face Somto begin para for that one say wetin that one dey do with her husband. She no just gree accept the fact say she don cast. 

See Somto wey I think say as she don touch money her craze go don repair small, Somto sef unleash one kind version of madness wey I no know say she get, maybe na this craze she bin wan use scatter my wedding that time she threaten me. Naso everywhere burst. By the time me I leave the hotel when dem start to fight, the two of dem don almost tear eachother cloth finish. 

 That night I nearly drive round the whole lagos dey reason my life, before I meet Dabota, i don comot hand for anything relationship, I just dey freestyle with any lady wey ready to open leg without feelings because I see shege no be small for women hand. I just dey knack ashawo anyhow and e dey go well because nobody dey catch feelings until I begin manage my neighbor househelp Joycee, that one nearly use fuck blind me. 

Since when my neighbor wife carry Joycee come one time wey she go village come back na eim I begin reason Joycee matter, but I say make I respect myself. Village girl wey gather hot body pass most of all this city slay queens. 

I wonder how she take get that kind oversize nyansh wey she dey drag for her back, nyansh wey be like say dem attach am to her body. sometimes if she dey do something for the compound and I wan enter my car to comot, I go first take style feed my eyes, especially when she wear that her black bodytight gown, the two large balls of her nyansh separate well and e go dey sway like say person dey somewhere dey control am.

I bin no wan cast myself, so I no make move until after one day wey I pick Joycee for road when I dey drive home from work, she say she bin dey come from market, ordinary the small drive from our estate gate to the compound we talk plenty, gist well, this girl give me detail of almost everything wey I dey do for that compound, she even know the days wey I no dey go work. E shock me aswear so this girl sef don dey watch me since…

 Na after that day Joycee begin her own agenda, na everyday she dey come knock my door say she wan borrow this she wan collect that and I notice say she dey always come anytime her Oga dem no dey around, and the kind cloth she dey wear come you go know say this kind coming na to cum. 

Even the way she go dey do her body loiloi like snake, sometimes she go just do her eye one kind. Me I dey notice everything but I say make i wait for the day she go enter my trap fulltime. E get one morning as her oga comot, Joycee carry her small button phone come ask me if I get extra battery for the phone. 

Na extra fuck I give her that morning, see person wey dey find extra battery come my door with one kind small armless top abi na gown because the thing end for her thighs, she no wear bra under because I first sight her bress from the side of the gown top. 

I remember say I bin get one of those small battery somewhere so I first invite her enter my apartment before me I go room begin find the battery, as I dey find am na so I dey think of how I go fit fuck Joycee that morning. I later see the battery for inside one drawer for my room, I carry am go give am. as she collect the battery, thank me com turn to dey go, naso the battery fall for ground, na eim this girl bend down to pick the battery—- boom!!! 

See fresh toto wey just hang between her leg dey peep look me, na then e hit me say this girl dey give me signal.

She never stand up finish wey I grab her waist from behind, she first do like say she no want o, but when I begin kiss her neck dey squeeze her breast she come mellow dey moan, she even begin use her nyansh dey rock my penis wey don already stand hard. Na for parlor I first knack her better doggy before I carry her enter room top am two long rounds….. I just dey pity people wey dey go village go marry onto say girls for village na saint because upon say me I be fuck ambassador I still dey learn work where Joycee dey. 

From that day we begin knack almost everyday because I dey go office by 9am so immediately her oga dem comot by 8am she go rush come my place collect morning dose, we dey baff together sef. Some nights she go sneak comot from their apartment wey we go run quickie or she go sleep over, sneak enter her place the following morning.

Until I no see Joycee for some days, na the gateman for our compound tell me say dem don send her back go village, say she dey fuck her oga and the madam catch them one afternoon. I no even surprise because the way that girl dey fuck you go know say this one don dey collect penis no be today. 

Omo as much as e pain me say Joycee go, I still thank God small because that time I don already dey addicted to her toto and I know say if we continue as we dey fuck I go definitely give her belle. 

Na after Joycee I meet I Rose one student like that wey say she too don lock up for love. That wan nearly use billing wreck me, she dey bill me left and right like say I be her ancestors, the only thing wey make me dey chest her billing na because she dey deliver. 

Wetin I really like Rose for na as she take dey reliable, even if na for midnight I call am say I wan fuck, she go find way come my place. I comot cap for Rose if e reach to suck preek, she dey handle my preek like say na wetin she study for school, e no get when she suck my dick wey I no misbehave, she sef sabi say na my weak point be that, so anytime she wan tax me she go first use mouth mesmerize my penis, before she go allow me fuck nonsense comot from her toto, then the heavy billing go follow. I no too dey worry sha atleast I get the money and she dey do me well.

After Rose graduate from school, travel go her base— naso I go back to dey fuck ashawo until I jam Dabota. I remember as I take meet Dabota for one of our rich client birthday party, na fall at first sight do me that day. Dabota get one kind intimidating body wey fit make person loose guard, me wey no dey dull for woman, that day I nearly jonze as I mount for her front. She get height, come thick, her bress na Kilimanjaro the thing big and the bra she wear that day just push everything enter person face. Wetin Dabota carry for back na the plural of nyansh with her wide hip. Na all that package motivate me to go approach that evening.

After we begin relate well, I no even waste time I tell Dabota say na marriage me I want, she sef say na wetin she want say she no dey play. 

We no fuck for the first five months wey we date, aswear I no know how I take survive all that five months because till today I still think Dabota use juju for me. for my mind i dey reserve her, I no know say I dey reserve ashawo. 

We go just kiss, touch small, we dey form temple of God until one night wey she come sleep over, normally we dey sleep for same room ontop same bed and nothing dey happen, we go just cuddle, aswear na jazz Dabota take hold me down then.

That night na from deep sleep I begin feel like say something dey happen for my body, I wake up open eye small see say Dabota dey caress my preek, she just dey use her finger dey run my dick. 

I do like say I still dey sleep say make I dey look wetin go happen, small time she carry her mouth jam my mouth,  I return the kiss but I say make I no rush am afterall we dey kiss regularly. omo that night kiss different, na when she carry my hand put for bress I know say e don set, I begin squeeze her bress dey fondle am, my hand no even pack am full because her bress big well well, I start to comot the button of her nightwear small small she no stop me…. I say nice one, I bring her huge bress out dey suck her nipple. She just dey moan dey rub my head till she move my hand again go for her pant side.

Omo the kind heat my hand jam for that side mad me, I push the pant open one side put my finger inside to test wetness level, Dabota don wet well well her whole body just dey hot— for my mind I say since she don give me opportunity like this make I kukuma finish work, I kiss her belle up to her neck and then go down again this time I reach her pussy side, she shake dey laugh wan kind laugh. 

Before she go change her mind I comot her pant vooooom open her leg well still raise am, if you see as her pussy dey shine bright like my future come clean join. I bury my head between her legs begin chop this girl meat sotey she begin cry, I no send am I just dey suck dey lick every part of her pussy as if na assignment wey dem give me.

As I dey use my tongue dey dig her toto naso I dey use finger dey tease her clitoris, Dabota begin dey make sound like say she dey sing for choir, when I finish with her punani, I carry mouth go continue work for her bress again, that time my preek don stand kakaraka. 

She sef comot my prick she first baptize am with saliva before she give me senior blowjob, my dick full her mouth like lunch, na as she dey give me head I confirm say I go marry her. After we don chop each other well, I lie her down spread her legs first use my penis tap her pussy small before I push am inside her toto, Dabota toto make sense ehnn, e no too tight and e no too free e just dey moderate. 

We first run missionary position before she give me reversed cowgirl wey she ride me like say I be okada. Na doggy I take close service for the night.

The doggy no be here cuz Dabota nyansh balance, and she sabi position herself very well, I just dey do praise and worship for my head say finally I fuck this wide mighty nyansh wey I don dey eye for over five months, Dabota nyansh soft pass new bread and you need see as her nyansh bin dey bounce as I dey smash her, e get when Dabota sef begin jam her nyansh meet my penis as me sef dey jam her, if you dey outside dey hear the kpatakpata sound you go think say na war we dey fight. 

All throughout that night wetin sweet me pass na say Dabota no lazy for bed atall, as I dey work naso she sef dey work, e come be like division of labor.

From that night omo na me nearly run sef, Dabota nearly use knack finish me. E no reach two weeks after our first fuck wey I propose give her, we begin plan for our wedding. Na after the proposal Dabota suggest say make we stop to dey kpansh until our wedding night, na that time I meet Betty. 

Kai I just remember Betty and that our last knack for hotel before my wedding, if she hear say my wedding wey she organize don crash she go laugh me. na Somto I know say the thing go sweet pass she finally get her revenge scatter my marriage somehow and I no even still fuck her again, only that head wey she give me for car.

Till today I never still grab how I no figure say Dabota dey run street, na after that day I begin hear different stories how my wife dey knack knack people for the whole town, the one wey shock me na when even Linda call me gist me how she still arrange men give Dabota even after we don marry. 

I nearly mad, how I no even suspect. I know say I knack outside o but omo Dabota code her own die, that girl for kill me for house nobody go know. 

No wonder she no gree carry belle make her market no spoil—all that time I dey think say I marry independent woman wey be content creator I no know say na all this dem alhaji dey fund her expensive life. Like play like play I marry ashawo keep for house.

After that incident all man go eim separate way, as I dey hala say I no fit forgive woman wey dey cheat, naso Dabota sef say she no fit dey with man wey dey do another woman. Marriage wey no even reach 2 years collapse like wall of Jericho!!!

The End

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 7346 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics