September 16, 2024


YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 3) [18+] {PIDGIN}

 

Home » YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 3) [18+] {PIDGIN}

YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 3) [18+] {PIDGIN}

Shame no gree me do anything because if you hear the kind yanmayanma talk this girl dey public dey shout, as she dey talk how I take fuck her toto scatter, na so she dey talk how she take do countless abortion, she even talk about the money wey she borrow me one time when I bin broke small, how I take dey heartless, Somto just open mouth talk everything. 

When some people notice say the matter don pass normal, dem come help me pull me from her hold, by then she don already tear my shirt comot three buttons. That girl get craze full body, even as dem hold her, if you see as she still dey para like all this big dog wey the owner dey hold from biting person, na eim I quickly rush enter my car drive comot from the place.

Months pass, Me and Betty chapter close, we no get any reason to see again; afterall we don already use knack settle ourselves and I even hear say she and that her bobo later marry, but deep down I no dey fit forget that our last fuck. Linda sef turn past tense for my life if not for one afternoon when I dey office wey Dabota call me say make I try come house early say Linda and some of her friends wan come pay us visit us. 

For my head I say ahhh!!! wetin dey carry Linda come my life again when I think say everybody don clear, because me I no too trust myself for where Linda dey, I know say as far as say she dey around me I go wan smash am. 

And na exactly wetin happen be dat, na for that visit i fuck the most risky knack I don do for my entire life. Make I gist una how I take risk everything for Linda toto. 

That evening I reach house late small because I stop for one store buy wine and some other things wey Dabota say make I buy come. Dabota friends sharp all of dem fine well well get fresh body, you go easily know say dem be rich classic ladies and most of them too na popular social media influencers and content creators like Dabota. 

Nyansh and bress just full the whole house, every corner I turn I go see bress dey look me, nyansh just dey clap kpakata-kpakata everywhere, but na still Linda own off me. 

Aswear of all Dabota friends wey dey that evening na Linda enter my eye pass, just few months wey I no see her she don add new features for her body, if you see as this girl ripe inside the short black gown wey she wear, no be only say the gown short, e get as the dress just push out her whole shape wey my eye no gree comot from her body, the cloth just dey bring flashback of our past and my gbola begin rise anyhow, ordinary as I dey look her I don already fuck her six rounds inside my head. 

Linda sef notice say I dey watch her like CCTV camera na eim she too no gree comot from my front…..she just dey feed my eyes, small time she go waka make her gigantic water water nyansh dey shake kporkotoko for my face, I just mumu there forget myself. 

I ask Dabota if she go like make I call some of my friends to lighten up the place because me I just feel odd as the only male for the house among about eight ladies, she no gree say na all ladies gathering say I just dey because na me and her be the host. 

I say ok o, me I just dey one corner dey sip one kind expensive wine wey dem buy come. 

Small time I enter the visitor’s toilet wey dey for parlour say make I piss, the gathering sef tire me because na just women thing dem dey do, na so so gossip and noise dem just dey make inside my ear. I say make I call Emma see if eim go fit come around, I still dey inside the toilet dey dial Emma number for my phone when the toilet door open waaaa!!! Linda rush enter inside jam the door. I shock, even though I know say we don dey eye ourselves since but omo I no expect this kind dangerous move.

I just stand put dey look Linda, my head wan explode, two seconds my preek don hard, which kind wahala be this one bayi, I know the situation tight but nobody go see the kind food wey dey my front reject am, I first go lock the door well before I pull her close begin kiss her, as I dey kiss her she no even waste time she comot my preek out hold am like dagger, the short elastic gown she wear no hard me to fold up, sharp sharp I position Linda make she hold the toilet seat set her nyansh for me, na the nyansh wey she use dey scatter my head I wan punish, as I slide her g-string go one side put finger inside her pussy I see say the thing don wet but e never wet as I want am. 

I first play with her clitoris small before I pour spit for my palm rub am for my penis head make e wet, I pour another spit again, this one I use am rub her toto to prepare the way for my entry, na she take her hand drag my preek first rub around her toto before she push am inside her wet pussy. I grab her bress from behind make I balance well begin jam her nyansh.

Linda begin dey make her normal craze noise but I make sure say she no loud am make we no cast, but she still do small werey, me I just dey rough her breast like say I dey pump am, dey fuck her wide nyansh, small time I sit down ontop the toilet seat she come open her leg finish sit ontop my penis, if you see the kind fast ride this girl ride me, me sef I fear say my penis fit break. 

I use vex comot her breast from the gown, I no suck am immediately o I first watch am as e dey fly for air as she dey bounce ontop my preek, the thing give me one kind joy. small time I grab her bress put inside my mouth, I know say that one mad her as she take two hand hold my head come intensify the bouncing, e reach when she begin make loud noise but I quickly use hand cover her mouth.

 But e be like say e don too late already because person begin knock the toilet door, na so I grab Linda waist hold am make she stop. I quickly answer the person say I dey inside, the person just say ok waka go, I know say na one of the other ladies because if to say na Dabota she for try open the door to join me. 

Immediately e sure me say the person don waka go I tell Linda make we stop, omo she no gree oo, she just continue dey bounce ontop me untill she begin vibrate dey shake, Linda squirt full the whole place, the thing enter me for body kpa, for my head I say what is worth doing is worth doing well, na so I jerk her up, pin her back for wall, she sef wrap her leg for my waist, I hold her legs open am well, na there I finish work fuck her toto responsibly, she just dey bite my neck and ear dey whisper wetin I no understand inside my ear.  

Omo na so I take fuck Linda inside toilet for my house, that short impromtu smash wey we knack that night I cum two times, Linda sef cum twice, as the fuck dey risky na so e sweet, afterall dem talk say na wetin u hide dey do na eim dey sweet pass. 

Say nobody catch us that night na miracle, na me first comot go upstairs shap shap go clean up arrange myself because I don rough finish, before Linda too comot go join her friends, by then we done use fuck redesign the toilet, e sure me say she go just dey smell fuck fuck throughout the remaining time she dey my house that night.

After that eventful evening with Linda, all man just dey eim lane, finally I dey free from Linda because as she go back, me and am no even connect again at all, me and my wife gum together well, she nearly use fuck finish me, chai Dabota like fuck and she sabi fuck well well, na every corner for our house we dey knack, sometimes na from door we dey start am, if I just enter inside house from work she go don wear one kind sexy cloth dey wait for me, if I enter she go carry nyansh jam my preek for door, na from there we go begin knack till we enter room. 

Normally I no suppose look outside again with the way Dabota dey serve me knack, but as an unfaithful man wey I be, i still dey run matter outside. Even with all the kpansh me and Dabota still dey get issue because she no gree get belle, Dabota dey use medicine dey block belle steady, we argue the matter plenty times, she go talk say she never ready to get pikin and my people begin worry say which kind wife I marry wey never get belle after a year of marriage.  

Na one business conference I attend for Ibadan wey I jam Somto again after over one year wey she do that drama for supermarket, she sef come the conference, if u see as fear hold me as our eyes jam, she no even send me, Somto just package herself waka pass me go, me sef respect myself I no near her. 

Na later during lunch break for the conference she come join me for where I dey chop, you need see as Somto calm dey ask of my wife and work, e shock me o, but I just dey answer her question with fear. 

For my mind I say shuuu… No be this same girl wey bin wan bite me the last time we see? Somto even talk say she go like follow me go back to lagos if I go still enter lagos later that night. 

Normally we finish the conference late that day, but before then me I don make up my mind say anytime wey dem finish me I go still travel go house because na since the previous day I don comot from lagos and I don already dey miss my wife, so as we finish I begin reason to go back, but I first think am if make I call Somto or make I just give her one excuse leave her travel back to lagos. 

Omo my mind no rest, what if this whole thing na arrangee, this kind change wey Somto change dey strange, no be the same Somto I know be this at all, I think am say maybe na scope wey she dey play to catch me. 

What if na plan wey she dey run to set me up, things just full my head because me I dey always tell myself say no be me go spoil my marriage. 

Finally sha I make up my mind say I go drop Somto for lagos, make I just do nice guy afterall nothing go happen. Before I begin my journey I first call Dabota tell her say I no dey come that day, say first thing the following morning I go begin come, I bin dey plan to surprise my wife sha. She say she dey house dey prepare dinner, say make I call her before I sleep.

i meet Somto for where we plan to meet…. this girl still set well, she wear one fine brown dinner gown wey finish work for her body, Somto no too get nyansh like that but wetin she no get for nyansh na for chest the whole thing pack full, just one of her bress na the size of my head. 

If you see bress as e full her chest me sef come dey pity her if the thing no too heavy for her. Throughout the drive I no fit concentrate….. I just dey use side eye dey look her huge bress dey imagine how e go be if I bury my head inbetween the massive flesh. Somto sef notice but she no mind we just dey gist about life and business. 

I find out so many things don change for her life, she don become one big time investor with enough money and connection, I no even bother ask how e happen, afterall everybody sabi say woman fit jam opportunity overnight. The funny thing be say we no even talk about our past at all, we just flow.

 

We reach lagos around 10pm, Somto say make I drop her for any hotel around town, say she no wan go her house that night, we begin find hotel until we finally see one. When we reach the hotel car park, as she wan comot from the car na eim I pull her close make we hug afterall we relate well, person no go even know say we bin get matter before, no mind me I just wan feel that bress innocent hug wey I feel her full bress for my chest my penis begin reason for me, the hug tight com long small we just gum till I try kiss her she first comot face, that moment all the fear and caution wey I don take since disappear, conji na very bad disease, na the second time I try kiss her she come gree. 

Na wetin I bin like for Somto that girl fit use kiss make devil repent, she first use kiss finish me, as the kiss intensify I grab her bress, she no stop me, I say ahh this one go well, as we still dey kiss na so I dey fold her mighty bress she just dey moan inside my ear, na inside motor we dey.

 Somto comot my preek from my trouser, that yeye man don hard kakaraka dey breathe, her hand soft ehnn my body just do jigijigi as she begin stroke my penis. 

Small time she bend I see say she wan suck my preek, for my head I say halleluyah! She first use tongue lick the cap of my dick well before she put my preek inside her mouth, omo I wan burst, aswear her mouth no different from toto wey wet, Somto sabi this blowjob thing die, see me see heaven. i grab her small nyansh dey squeeze am. 

As she dey suck me e just dey unlock memories of our past, Somto dey always dey calm for fuck, but na for fight she dey get craze. I try fold her gown to find her pant atleast make I tease her toto but my hand no reach as she still dey suck me, I say make I no distract her make I just concentrate dey play with her nipples. 

She just dey make noise as she dey anoint my dick with saliva until when I no fit hold am again, I begin shake like person wey electricity shock, i cum inside her mouth, she no still stop she continue dey suck my preek even lick my cum. She come whisper tell me say make I follow her enter the hotel. 

See speed I take comot from car follow Somto for back like cow wey dem dey lead go slaughter, my penis done stand gidigba finish, that moment I no wan reason say e fit be setup or anything I just dey march follow her, as we step enter the hotel reception hall, Somto go the receptionist counter go arrange room while me I go the bar wey dey one corner of the reception say make I collect wine to support the night’s ministry. 

I collect the wine turn to go meet Somto where she stand dey wait for me, na eim my wife Dabota waka enter the reception with one big fat man wey wear agbada, the man hold Dabota for waist wey she sef just dey shine teeth the man even kiss am. 

If you see the kind bumshort with open top wey my wife wear, as she raise head look front naso both of us just jam gbam!!!!    

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 7870 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics