December 3, 2024
YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 2) [18+] {PIDGIN}
Home » YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 2) [18+] {PIDGIN}

YeyeGist: Chike’s Dilemma (Chapter 2) [18+] {PIDGIN}

If you see the speed I take comot my preek from Betty toto wear my cloth, Betty sef run go hide for back of door, I rush go check who dey knock make the person no go enter jam us, when I reach the reception hall i see say na the security men. 

Dey say dem dey do routine check and wan confirm if we still dey the office, I know say all na scope, dem don hear our noise tire, e sure me die say conji sef don hold dem. I discharge dem sharp sharp say we dey try fix something and we go soon comot, I know dem go just dey look me like fool for the kind mumu lie wey I blow. 

As dem comot, me and Betty tidy up leave the office, I no wan take risk again besides I just dey wonder wetin the camera go don capture sef. We no even go the dinner again, I just go drop her jeje for her house.

After that first day, me and Betty begin dey knack almost everyday, if we no camp for hotel we go do am for her house or sometimes we dey run quickie inside my car, as guyman wey I be, I no ever try carry her go my house make I no go cast fulltime.  

Naso we dey fuck in peace and I dey treat her well until e reach one day wey she tell me say she no dey comfortable with the whole thing say her bobo don dey suspect, na so we stop to dey knack. 

E pain me o but I just free am, afterall we no dey do anything serious, we just dey help eachother cure conji. Besides that time i dey always fear make she no carry belle because we dey always fuck raw and I dey pour full tanker load inside her. 

Normally if I be her bobo I go suspect because the kind wild rough fuck me and Betty dey do any sharp guy go know say another machine dey service her punani. 

since that day wey me and Dabota meet Betty, anybody wey Dabota say she wan introduce me to, naso I go dey fear, make e no be person wey I don knack before, since her bestie na my former fuckmate and our wedding planner na person wey I don hang leg pipe well well. 

The way everybody just take connect that moment be me like film trick, even though me and Betty no dey fuck again anytime she dey around me e get as my body dey do me especially if I remember as we take rock the small time wey we dey together, but both of us just cooperate dey on our separate lane.

Just four days before our wedding, I dey house dey chill with my guys for afternoon, na eim Dabota call me for phone say make I help her go pick Linda for the hotel where she lodge bring her come meet her for where she dey with Betty. 

E no get excuse wey I no give my babe say I dey busy wey she gree hear, because since that day wey me and Linda jam for Dabota house i just dey avoid Linda, I no want any other temptation join the one wey I don dey especially anytime wey I remember say I still get Somto to deal with.

No be say I no for like kpansh Linda o, afterall me and Dabota don dey do celibacy for the past three months so that when we go marry the whole thing go still dey fresh even though we don fuck tire before. 

That three months no easy for me atall, conji for don kill me, if not for say na that period I meet Betty and as me and Betty end our fuckery I just dey, I don already comot hand from ashawo say I no go dey fuck ashawo again. 

The thing be say, anytime Dabota tell me say she dey with Betty my mind no dey everly touch ground, na so fear dey always catch me, make that one no go open mouth cast me. Atleast I know say when me and Linda dey together I never meet my babe but this Betty own na just few months ago when I don even dey engaged.

Dabota beg me well well, she sabi my weak point say I no dey fit resist her anytime she beg me for something. las las I finally agree say I go help her go bring Linda when I finish wetin I dey do. Na when I drive reach the hotel I remember I for carry my guys join body make chance for anything no dey. 

I park car well for garage call Linda say I dey the car park dey wait her, she tell me say make I come her hotel room say she dey with person and she go waste small time, for my mind I say since she dey with person nothing go fit happen, naso I go her room.

 Omo as Linda open door for me, my eyes nearly roll comot, the first thing my eyes see na her fine portable breast, e get as her breast just new for my eyes like say I never see breast before, if you see as her breast fresh, ripe come full inside the small bra wey she package am inside, the bra no even cover quarter of her breast, infact e be like say na only nipple the thing cover. Even the bum short she wear almost be like say she no wear anything. But true true she dey with person, one hotel attendant!

I just sit down gum my eyes for television dey watch wetin I no understand, I look as the attendant dey change bedsheet and pillowcase I know say she no go waste time at all, she go soon finish comot and e go remain only me and Linda inside room, my mind tell me say make I go reception go wait, another mind tell me make I dey see wetin go happen. 

All that time Linda don enter baffroom….. See person wey Dabota tell me she say don prepare finish dey wait for me, na now she just wan baff.  Small time the cleaner do wetin she dey do finish comot leave the room. Me sef get up go near the baffroom door tell Linda say I wan pick something for car she say ok.

That girl na confirm bad girl, she already know say I wan run, because as I dey waka go the door na so I hear sharp scream from the baffroom, omo wetin happen? if you see as I take fly push the baffroom door enter the baffroom, Linda just stand dey point one corner for the baffroom say she see something like snake… snake kee! me wey normally I no like snake I tell her make I rush go call the hotel people.

Na eim Linda say na the snake wey dey inside my trouser she see, this evil girl come burst laugh. Instead make I vex because of the tension she put for my body, Na even that time I notice say she no wear anything, the mumu me come dey look body. 

Mehn she add up well, her breast don double, even her nyansh sef don turn oversize, no be the moderate nyansh I bin sabi before, my mind tell me say this girl don do all this surgery wey ladies dey do.

 As she talk that snake joke, with the kind body wey dey my front, naso my yeye penis wey no dey hear compliment begin breathe inside trouser. Linda sef notice the movement because na light joggers I wear, she come smile one kind wicked smile, na wetin she talk mad me finish. 

She say her toto don miss my dick, this girl begin talk plenty plenty dirty things, dey hype as we dey knack those days, i first stand put dey smile, dey admire her body until e reach when I no fit hold am again. 

I waka go meet her where she stand grab her hip, naso we begin kiss dey chop lips, I no even mind say soap still full her body and she dey wet my cloth, as we dey kiss I run one finger inside her pussy, omo everywhere go well, she sef raise her leg up, I put the second finger join, that one follow soak, as I begin tease her pussy with my finger, e be like say I plug her charger, Linda grab my shoulder begin kiss my neck dey bite me. 

Na that time she whisper for my ear say make I give her the best goodbye fuck. Haaa! My penis nearly tear my trouser. 

If person tell me say I go fit carry her one time as she thick like that I no go believe, aswear e get the kind energy toto dey give man. Naso I jack her comot from baffroom enter room put her for bed, the rush I use comot my whole cloth you go think say fire dey the cloth, i divide her leg well like compass, her whole toto just shine face dey look me, the thing fat, get extra meat full am, as my preek enter her, remain small I begin sing victory song, kai I don miss this toto. 

The speed wey I take begin knack her me sef fear if my preek no go spoil something for her body because I just dey enter deep, Linda sef never change, she no even mind say the sex rough, she just dey talk bad bad things wey dey ginger me more.

Small time she lock me with her two legs, for my head I say na here I die, I know say I go soon release and I no fit risk am release inside her but I no fit stop to think anything I just dey drill her toto dey go, as e reach time wey I wan release I try pull out but linda hold me tight still lock me with her leg well come press me gum her body well say make I no worry say she go handle am, na so I release the whole thing inside am. 

Normally fuck no dey tire me, My preek still hard, e be like say na wetin God take bless me as I no too get body. E dey hard before I release and no be like say I dey take any drug, na why when I still dey fuck ashawo all of dem dey run from me because I no dey quick release, naso some of them go dey under me dey cry for help.

 For my mind I say if I no fuck this Linda nyansh my ancestors no go forgive me, sharp sharp I turn her, she sef give me the full back still spread her leg as she kneel ontop bed, Linda nyansh soft like nylon wey dem put water inside. 

My preek enter her wet pussy like say dem exclusively create her toto for my penis, aswear her nyansh sweet to fuck, that moment e come be like say all the other nyansh wey I don fuck for my life na counterfeit and Linda sabi whine her nyansh dey use am collect preek. 

Wetin off me pass na say I dey fuck person for toto I dey taste sugar for my mouth, as in the sweetness reach my tongue. As I dey jam her naso I dey spank her nyansh like old times, she sef just dey remind me of dirty things wey we dey always do then, my head wan burst, at a point I hold the nyansh tight concentrate well begin go 3 stroke per second, I just wan fuck her for all the years wey I no kpansh her.

Na my phone first begin ring I no  bother answer the call I no want distraction at all, me wey dey ontop project, as e ring finish na eim Linda own too begin ring, the phone dey ontop the bed wey we dey fuck, I peep look the phone, see say na Dabota picture show for the screen. 

Omo na so I freeze. As the face dey the screen e just be like say she dey look me as I dey fuck her bestie, Linda quickly push me comot answer the call, I just dey look Linda as she dey lie give  Dabota say she never see me o say she still dey wait for me, sebi I tell una say this girl na bad actress. 

As she drop the call, two of us just dey for bed quiet until she burst laugh come turn bite my ear. As I wan climb her my phone too begin ring again, this time I quickly pick am, na still Dabota, I increase the volume of the television small make I use the sound dilute my location, I tell her say I still dey house say I go soon dey go the hotel. 

Before I finish the call Linda don already enter baffroom, I follow her inside, we run short doggy again make I fit release, she suck my penis too small before we com baff together wey I carry her go meet Dabota.

As I drop Linda with Dabota and Betty, if you see as Linda code do like say nothing happen at all, na me guilty conscience sef come dey do coupled with the fact say Betty too dey there, panic wan kill me that evening, 

I dey with three ladies wey I dey smash, I just dey look as three of dem dey gist dey talk, as I wan go, Betty raise talk say she go like make I follow her go pick up the wedding ring from the jeweler, I bin wan object but trust Dabota the wedding just dey make her hyper active, she begin beg me make I help her follow Betty.

Betty wey me I don dey avoid like plague since that day wey Dabota carry me go meet her, na me know wetin I dey run from sha, because if you sef see the kind sexy body wey Betty gather, you go no rest. na as we reach outside Betty office, she say make we use her car, I reason am say maybe she no go dey comfortable inside my car with the kind things me and am don do inside my car na she drive sef. 

As we dey go we just dey gist talk about life and the irony of how she finally become the event planner of my wedding after she jokingly talk am that day wey we dey inside my car. I ask her about her man, she say her wedding too go come up soon say plans don start. Na when the car begin pass one familiar street the thing dawn on me say she dey carry me go her house, I just quiet I no talk.

When we finally reach her apartment I tease am ask her if na the jeweler place be this, both of us laugh. We know say na fuck we come fuck and the thing sweet me ehn…… me wey never recover from the kind rough ride I do with Linda but omo I no fit resist Betty. 

As we enter parlour she sit ontop my leg, we no even waste time, both of us know wetin carry us come, besides we need do fast go back go meet Dabota and Linda, na from kiss we start, from kiss we comot cloth Betty position ontop the couch hang one leg for the top of the couch, I first use my penis rub her pussy surface small still tap the walls well till pussy juice begin leak comot. 

I take corner eye look her face, she don roll her eyes enter another world, viaaam I drive my penis inside her, she just shake body like say cold catch am com hold me tight, as par say I don weak small from Linda fuck I no do long I cum ontop her belle, she sef dey disappointed somehow but I lie give her say my mind no too dey the fuck.

As we dey clean up she come tell me say make I carry am for mind say I still dey owe her better fuck. Me! Owe fuck… I say noo I no gree, make I pay my debt finish before my wedding. So we arrange to meet for one hotel the following day for night. 

Throughout that night for the hotel we no sleep, na marathon fuck we run till daybreak. Me wey don arrange better concortion join my normal natural energy, e no get wetin we no take our body do, Betty cum over five times, small thing she don squirt full the whole bed, and as she dey squirt na so she dey want more knack. 

That night Betty comot mind say she wan give me final fuck and me sef know say na settlement I dey settle her. The following morning all man go eim base.

Finally my wedding day reach, my mind no rest, anytime my eye jam Betty eye as she dey run around dey arrange things, I no dey fit concentrate, I just dey remember that night for that hotel, Betty fuck me one kind fuck wey I never fuck before for my life. 

I still bin dey look out for Somto wey say she dey come scatter the wedding although I arrange make policemen mount everywhere. Na Linda own worse pass, she just plaster everywhere for my face and the kind gown she sef wear with her gigantic ekebe, na so so fuck I dey see as I dey look her. 

Dabota sef no gree me rest, I no tell una but join Betty hotness and Linda sexiness na so Dabota sharp, you suppose sabi me say I no fit settle for less infact that our wedding night me and Dabota nearly take fuck scatter the hotel wey we lodge for. 

Two days after my wedding, i comot from the hotel where we lodge dey do our honeymoon say make I go pick few things for market, guess who I jam for supermarket, Somto! She just hook me for my shirt like say I thief her money begin para for the whole place dey shout full everywhere, e reach when people gather dey watch us, shame nearly kill me, I try free myself but Somto no gree and mesef I no wan dey violent so I just maintain dey watch her…

TO BE CONTINUED 

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here


      

This post has already been read 8531 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics