People dey do wedding dey happy, my own wedding day be like say I do something wey I no suppose do, I no fit even blink eye one second before everywhere go just scatter, I just dey on steady alert, always guarding like say I be one cultist.
The whole matter start 2 weeks before my wedding, when the preparations bin dey hot, first na one of my ex like that Somto wey appear from nowhere begin dey para say she no go allow me marry in peace, say e better make she die pass make she see me marry another woman, her main vex na say I no fit use am and dump after all the uncountable fuck we don fuck, nothing Somto no talk for the voice note wey she send give me say she go come spoil my wedding.
As I hear the thing finish, fear sef catch me because I know say that ogbanje girl get craze, if Somto talk say she go scatter my wedding that girl go do am. she even talk about all the belle she don comot for me, the same somto wey I go release inside her that time, beg her make she no drink medicine she go drink am, say she never ready to settle down.
All that time wey one yeye musician dey deceive am say eim go marry am. Omo but me sef I knack wetin no good for somto, I nearly use my preek change that girl destiny.
I bin no want make my babe Dabota know say one of my ex dey threaten me, so I keep Somto wahala on low key dey try reason with her.
Na inside that heat I dey when I find out say my babe chief bride’s maid na my former personal olosho when I bin dey work for porthacourt. That time I never meet Dabota and I no dey inside any serious relationship like that so I just arrange one babe make we dey freestyle I dey fuck am dey pay am steady.
Na she be the Linda wey Dabota don dey sing about all this time. E no get position of knack me and Linda no do that year–Shuuu na so this world small?
Infact to find Linda fuck am again na one of the reason why I bin dey plan to visit portharcourt. The thing just be me like say na setup when I meet her for Dabota apartment, imagine my babe dey introduce me to Linda, only if she sabi wetin me and Linda don take our body do for this life.
Linda wey even if dem blindfold me I go spot every part of her body. we nearly take fuck kill ourselves that time for portharcourt, only her toto fit tell wetin my penis do am, and Linda sef sabi fuck fire, preek dey give am joy like success.
Bad girl wey linda be, if you see as she code just package like say she never meet me before, na me almost loose guard sef but you no go too blame me sha, over shock wan kill me that evening. E even reach when I begin believe say maybe Linda don forget me true true because if you see as this girl act this thing ehnn.
Na when we later jam for balcony where people no dey she come clear me say make I behave myself say she no go want make her friend know say we get history, aswear I begin blame mysef say na me fuckup I for don try ask Dabota for her friend picture since when she dey always talk about Linda.
As we talk finish wey she dey waka dey go I look her nyansh, chai the memories hit me and the thing don even big add dey shake gbegede-gbegede, I remember how that thing dey vibrate if I dey give her doggy……… that moment I know say if I no take caution I go misbehave.
Like say that one never do, the following day Dabota carry me go meet the event planner wey she hire, lo and behold the event planner na Betty! Remain small I collapse for where I stand. Betty wey I still fuck e never reach 2months, even Betty sef shock to see me.
This time Dabota notice our reaction because the thing over throw me off balance. As we enter motor dey go house, Dabota ask me how I take sabi Betty. I lie give her say Betty na one of my former workmate ex.
Small truth dey inside the lie I give her sha…. Afterall Betty na Emma ex and na eim introduce me to Betty.
Me and Betty start to knack when my oga and eim wife bin wan celebrate their wedding anniversary, as I be the most senior staff for office dem put me in charge of organizing the whole occasion, omo the thing no easy me for me that time as I dey combine the planning with office workload.
Na eim Emma my colleague for office give me Betty contact say na eim ex babe wey dey organize event say make I hire her to ease the stress for me, naso I call Betty and me and am begin work together dey plan the anniversary.
We no even see face to face because of my tight schedule but we fix plenty things for the event through phone call and chat and we bin get along very well until one day wey we finally arrange say we go meet physically so I go make payment and verify somethings.
That day we finally meet for one sharp restaurant like that wey no too far from my office during my lunch break. When I see Betty that day I shock, how Emma go call this one ex.
Betty just be like all this hot ladies wey dem dey put for front page of fashion magazine, if you see her skin e be like milk come clear like mirror, as she dey talk I just dey watch her lips the thing full still smooth like chewing gum, e get when she excuse herself to go receive one phone call, as she stand up dey waka.
Na then I see her full figure, see thick body, slim waist with wide hips and mighty fat round nyansh wey just dey shake recklessly, me wey I don talk am say na nyansh go kill me for this life, my body do me like say dem plug live wire for my armpit. As we dey talk me I don take my eyes suck her huge bress wey occupy her whole chest, I just dey wonder how person go carry heavy duty for front and back perfectly.
Even as I see engagement ring for her finger I no send, afterall that time me sef don dey engaged with Dabota. We talk long before we come agree say the following day we go check out some event centers wey we fit use as location for the event.
Around 12pm the following day Betty call me to remind me of our appointment, since work full my table I tell her say I go meet her by 5pm. That 5pm na rush I take comot from office go meet her for one of the possible venue wey we wan check out.
I no even like the place so we no spend much time there. Na when we wan go the next place na then I notice say she no carry her car come, she say she use cab come, as we dey waka go where I park i take style do like say I dey press my phone delay small, make she dey waka for my front, omo this lady gather, for my mind I say God punish Emma.
She wear one kind short black leather skirt with one top wey her bress dey push the button like say e wan fly comot. with the way her nyansh dey shake I doubt if she wear anything under that skirt.
When Betty sit down inside motor for front beside me, na her thighs wan kill me because the short skirt come fold up, my eyes nearly roll comot, the thighs thick come fresh, even my preek begin stand small small but I give am warning.
Betty sef notice say I dey look her lap, she come use her small hand bag cover am, e be me like say make I fling the bag comot. Na around 8pm we finish the whole wakawaka that day….. We check about four other event centers that evening before I pick one wey dey for island, me I sabi my oga well, I know the kind classic thing the man dey like and the man sef comot money well well to celebrate the anniversary so I make sure na the best I pick.
As we finish for the last place I say make I do gentle man since both of us sef don tire. I tell her make she join me for dinner, but say I go like reach office go pack my things first.
Na so we drive go my office, on the way we just dey talk random things, her business, we talk about the anniversary, she ask who recommend me to her, I tell am say I see her posts online and I like her whole package.
I take style talk about the engagement ring wey she wear for finger, she say she dey engaged and she and the man go settle down before the year end, I sha tell her me too dey engaged, she even joke say she go like plan my wedding o. Na when we reach my office complex I remember say Emma bin warn me make I no let her sabi say me and am dey relate well, because both of dem no breakup well.
Everywhere don already dark, just few security lights, everybody don go house except for the security men on duty, I tell her make she wait for me for car, she no gree say she no wan dey alone, me and am enter together.
As we greet the security men waka pass, I imagine wetin dem go dey think for their mind with the way Betty set, me wey everybody sabi say I go soon marry Dabota. We enter the office reception, I switch the light on, tell her make she wait for reception, this lady still no gree oo say shey I no want make she sabi my office.
My penis tell me say this girl dey find trouble. Na when we enter my office she ask me if I sabi Emma, as a sharp guy I tell her I be new person for this branch say I sabi Emma but we never too dey roll well since I just dey settle in.
I no know if she believe me or not but she begin tell me how she and Emma bin date, how Emma bin dey cheat on her wey she catch am several times with other girls, all this time she don sit down for couch for my office.
No wonder Emma give me that warning. As she dey talk my eyes just dey jump from her lips to her breast to her thighs.
Omo! Naso she begin cry o, me wey don pack laptop, carry bag, I drop everything sit down beside her dey console am, if you see as Betty fine for face when she dey cry, you go wish make she just dey cry forever.
Person dey cry but na my dick dey stand, I pull her close hug her tight, she just rest head for my shoulder dey cry, if you see as she wrap hand round my body like say na she get me, me I just dey rub her back gently, this girl body soft ehnn come dey scent nice, all this time rod of Moses no strong reach as my preek hard.
Boom! Nepa take light, everywhere just dark, for my mind I say ‘this is the sign’ my head begin run 360, if I no fuck this girl or atleast touch am small I no go fit sleep that night, I say make I just try anything since she do already submit body.
I come free myself small, hold her head with my two hands, I know say I dey face her but we no dey see each other as everywhere still dark but I dey feel as she just dey breathe ontop my face, na her nose I first kiss before she raise her head meet my lips, her thick lips nearly consume my whole mouth, for my head I say shey na this same person bin dey cry now now.
The way she take dey begin kiss me deep I know this lady bin don dey reason me since. I make the next move raise Betty up make she sit on my leg, she sef com help me unzip her skirt still fold am so that she fit balance well ontop my leg.
As we dey kiss I take one hand dey fold her skirt up dey rub her thighs, she no stop me, when I notice say she no wear tight na just pant under the tight, the thing mad me, I continue dey fold the skirt up until I fold everything pack keep for her belle, as I dey raise her make I fit open her thick lap so that I go position myself between her thighs I allow make one of my finger slip near her pussy, omo see heat for that side.
Betty begin use rush comot the button of her top come press my head for her big breast, me I no even waste time I just grab her breast begin suck her nipple they squeeze am like say I dey expect make something comot.
She just dey moan dey rub my head, I feel her nipple inside my mouth the thing big come hard well well, them fit take am stone pikin make the pikin cry. My penis don almost break with her weight ontop my erection.
I raise her up small Betty sef help me go up small open my zip, she struggle with my boxers, comot my preek out, my body shake as her cold hand hold my penis. I just take two hands grab her breast together like say na trophy begin suck am fast.
She rub my penis tip small use the precum wey I don already release wet the whole head of my dick before she use her finger shift her pant one side come slide my penis inside her pussy. Her toto no too tight but Kai, this woman punani sweet die and e wet like say rain fall inside.
She begin ride me slow, then e get when she increase speed begin ride fast then she switch go slow again, Betty just dey do me slow and fast and the thing mad me, e get when me sef come balance well for the couch grab her nyansh tight begin fuck her from under as she dey ontop me, as I dey fuck her fast the thing wild her, I no know whether na cry or na laugh, she just dey make sound full the whole office dey bounce ontop me.
With her big breast inside my mouth, my penis inside her toto, that heavenly feeling with another man’s fiancée. We do that position for over 10minutes nonstop I just dey fuck her hard pa pa pa pa pa before I release full load inside her.
I say make i position her for the edge of the couch so that I go fit attack from behind, na eim nepa bring light back, omo if you see as Betty arc for doggy you go know say this wan na fuckmando. Even nepa sef want make I see her nyansh as e set, the view of her nyansh from behind burst my head.
I begin fuck her nyansh like say e get wetin the nyansh do me for my former life, I no even give her space.
The sound of her nyansh as e dey jam my groin alone loud well well talk more of the noise wey she sef dey make, naso Betty just dey shout full the whole office dey speak wetin I no understand but e funny me say na that noise dey motivate me.
I know say the security men go dey hear us because omo Betty loud like and she sabi speak in tongues, I just dey imagine as dem go dey see me after that day, but that one no stop me, the most important thing be say make I fuck this toto well, satisfy her so that she go give me chance for next time.
Nothing I no do Betty nyansh as I dey fuck her, I squeeze am, rub am, spank am. Even though na ontop couch we run the whole thing e no get position we no try.
We fuck for like straight forty minutes altogether and na so she dey shout dey make noise, omo Betty sef na E for energy, she no gree tire. If her toto begin dry she go put spit for palm take am rub my dick and her toto everywhere go wet again. Naso we continue dey fuck until we hear knock for the main reception door.
We freeze!
TO BE CONTINUED…
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 12547 times!