October 17, 2024
YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 9) [18+]
Home » YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 9) [18+]

YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 9) [18+]

I freeze like say person dey one place press my pause button, I just sit down for bed dey read the message, over and over again. E no get anybody wey I no suspect that moment, e reach when I suspect God sef, say e be like say na heaven wan punish me because this time me sef I know say my sin don pass normal sinner own. I fuck my pastor wife inside church compound.

Because how ordinary small fuck wey I fuck mummy church for afternoon go cast before midnight, somebody don already know, dey threaten me with message. Naso sleep vanish from my eyes like say dem bind and cast am comot.

The number sef na anonymous number so e no get as I wan take reply the message or sabi who the sender be, I just dey think full my head, one mind tell me say e fit even be mummy church wey I fuck dey set me up, because me I no understand how person don already know the matter now now…

But I no sure say pastor wife go run that kind yeye play, afterall she get reputation to protect. Small time another message enter my phone, if you see speed I take open am, na the same hidden sender, this time the person ask say “wetin I go fit do to hide my dirty secret” omo na then e ring for my head say person wan blackmail me o.

Na that night I sabi all the faults for my ceiling because naso I just dey bed dey look ceiling throughout the whole night, dey reason the kind evil preek wey I carry come this life wey just dey land me from one yawa to another.

I reason am both ways, what if the person begin ask for money? omo me I no get that kind money o, I go just free am make eim do eim worst, highest the matter go cast everywhere for one month till e go still fade.

At all at all I go relocate shift go another place, change church, anything wey go happen between pastor and eim wife na their own business, afterall the man dey always preach forgiveness for church.

I try remember all the faces wey I bin see for reception that afternoon before I enter go see pastor wife, na soso old people, abi dem hear the noise she dey make as I dey lash her? Abi the sound proof door no proof anything?

Noise wey she make wey motivate me to pound her toto more, na eim don put me for trouble. I reason if na her receptionist, omo that woman dey too responsible to dey run this kind thing, besides na family woman she be sef.

I think of Nancy and Gloria, but how dem wan know say me and Mummy church fuck that afternoon when dem no even dey there. I still think am if na mummy church wan take style collect the money wey she wire give me after we fuck because no be small money that woman give me o….

But I say e no fit be, that woman pass that money. Aswear no mumu thought no enter my head that night, if I even try close eye say make i sleep small naso the message go just flash for my dream, I go jump wake up begin think again.

The following morning, fear catch me to even comot from my house, the thing just dey do me like say person dey watch me and naso I gum eye for my phone dey expect update form the anonymous person until I finally gather mind go office.

As I finish one small matter for studio dey enter my office for the radio station where I dey work another message from the anonymous person enter say make I expect call later for evening…….. This person nearly kill me with suspense o!

Throughout that day my mind no rest, food no even hungry me, because ordinary the matter wey dey ground reach to full my belle.

Na when I wrap up for office dey prepare to go house, my phone ring. E come be say na Gloria wey dey call, if you see as my head spin three sixty, so na Gloria dey do me all this thing, but how she take know say I knack pastor wife because I sure say I no see her there that day unless she later come when me and pastor wife dey fuck.

Before I rush attack her I say make I calm down answer the call hear wetin she wan talk. Gloria talk say pastor wife tell her say me and her suppose host one event, say she want make we see so we go discuss how we go take prepare.

Aswear ehnn I just confuse, if you see the way she calm dey talk, like say no be the same Gloria wey dey vex for me all this while, I tell myself shaperly say this whole thing na setup and I need play along to the end. I tell her say make she give me time and location say I go squeeze out time meet her.

Mummy church na werey woman o, I never agree say I go do the thing she don already call Gloria tell her, omo the way Gloria just calm talk to me that evening like say nothing sup between us I just conclude say na Gloria dey worry me.

E no reach 10min after me and Gloria talk wey my phone ring again, this time na hidden number, as I pick am, na female voice talk, omo that wan first burst my head say so na woman dey do me this thing since.

Aswear say make God punish skirt and blouse. Even as I know say the person dey try change eim voice, the voice no still resemble voice of anybody wey I sabi. The person ask if I don dey house? I tell her say I don dey go house, the person say make I dey go house say she go meet me for house.

As e shock you naso e shock me too say the person sabi my house. As I dey inside keke dey go house, I conclude for my head say na either Gloria or Nancy, but wetin I no still understand then na how dem take know say me and mummy church fuck that day.

As I reach compound I just dey look everywhere like say I keep person there, I see mama chidi house maid outside I ask her if anybody don come find me? She say she no see anybody. Even as I enter house as I dey change cloth, my ear dey for my door and my eyes dey for my phone dey wait.

Na that time I realize say I never even chop anything that day, honestly to enter problem no be good thing o. I enter kitchen say make I warm soup turn eba chop, afterall na fuck I fuck I no kill person. I dey inside kitchen when I hear knock for door, if you see fly wey I fly from kitchen to parlour, as I look through the peep hole omo I nearly scream— na Nancy I see for door!

I do sign of the cross five times, do breathe in breathe out plenty times before I finally open the door, I stand well for the door block entrance, afterall the last time she come remain small she take vex scatter everywhere.

Nancy beg me say she want make we talk, I first waste time small before I allow her inside. When we settle for parlor me I just dey wait make she tell me my whole fuck with pastor wife and how she take sabi everything but as she start to dey talk, na a whole different matter Nancy carry come, she kneel down begin beg me say na mummy church talk sense enter her head, say she dey very sorry for wetin she do—- she talk plenty things just dey apologize say she still love me and she want make we dey as we bin dey before… confusion nearly cripple me.

For my head I say which kind film be this one again, e sure me die say I no see Nancy for pastor wife office that day.

Again I suspect mummy church, because which kind game this people dey use me play like this. Na the same time one anonymous caller dey threaten me, na the same time Gloria and Nancy dey reach out to me after both of them talk with mummy church, the whole matter just weak me.

But as I dey reason all this thing I just dey look Nancy, this girl wear one kind bad short gown wey project all her shape and curves well, the chest region of the gown open kpa and I no go lie I just dey observe the big ball of flesh wey pop up from the kind push up bra wey she wear.

Preek wey I don take the whole day caution begin stand small small, as she kneel down wey I stand for her front I just dey see her whole huge bress from ontop as she fold am inside bra. I know say women sabi act, but this Nancy no be like person wey sabi anything about me and mummy church, she just dey beg me for her own self.

Abi na film she dey play give me? If Nancy no be the caller why she come for evening and how come the person never call or come since she come afterall the person say we go meet for house.

For my mind I say make I just play along dey pretend too until she use her mouth tell me everything, aswear I no get sense because even inside my confused head I still dey reason how I go fit fuck that her massive nyansh again…

Omo if you see Nancy nyansh you no go blame me and me I no dey take big nyansh joke at all. Na then I remember say I put something for fire, I tell Nancy say I bin dey do something for kitchen before she come, she ask me wetin I dey cook I tell her say I wan make eba say I get soup, Nancy get up say make she help me run am.

I shock because the Nancy wey I sabi anytime she come my place, she dey always prefer to buy food she no dey everly like to cook.

I bring the soup from the freezer, she ask me say who cook am I lie say na me, soup wey mama chidi give me after I knack her one kind better fuck. As Nancy dey warm the soup, I go hold her from behind I press my erect preek for her soft nyansh well make sure say she feel am say I don stand finish for her.

Nancy come off the gas turn face me ask me if I wan chop her before I chop dinner? Omo that question burst my head— if you see as I just jam her lips with my own wey we begin kiss, our hand just dey touch every part of our body.

I grab her breasts, pull her hair, squeeze her soft nyansh, she sef just dey rub my body until she break the kiss begin lick my ear and my neck, e get as she take use her tongue dey whine my ear, omo the thing mad me.

Both of us intensify the kiss well, I pull the hand of her gown off her shoulder, force her breasts out, na she take her hand unhook her bra make e dey easy for me, her huge breasts wiggle out I grab one quickly begin squeeze am gently.

The speed Nancy take comot my knicker and boxers like say we dey try beat one time challenge, me sef fear the way my preek take stand stiff, preek wey I think say go respect eim sef after I don talk to am the whole day, the werey don already hard even dey leak precum. She begin stroke my penis gently too, she tease my balls with her fingers, use my precum rub the tip of my dick well, omo that sweet sensation nearly ruin me for where we stand for the kitchen.

I take style dey pull her gown up as I dey grab her nyansh, over softness dey do Nancy nyansh, the thing soft come wide well well. I bend small use my mouth grab one of her breasts, one soft bite for her nipple, she shiver, she just dey rub my head.

I carry my hand go her inner thighs up till I reach her pant everywhere don wet dey wait for my triumphant entry, I use my finger shift her pant make my finger fit enter her, Nancy sef open her legs small make my finger see chance enter her comfortably, this time I still lock one of her breasts for my mouth dey suck am like say I wan extract mineral resources from inside am.

She just dey moan, dey rub my head, dey whine her body, as I dey run my finger inside her wet toto up to her clit. Her whole pussy don wet sotey the water wey dey drip do to use baff newborn baby.

I try raise her say make I carry her omo I no fit, the girl get weight die plus say I never chop since the previous day, I just respect myself make two of us no go fall for ground. She just hold my hand lead me out of the kitchen to my room.

Immediately we reach room, this girl no even face me she just climb bed pull her gown up finish, hold the head of the bed frame, position her nyansh for better doggy come begin dey wiggle her gigantic nyansh, remain small I cry tears of joy.

I first observe her mighty ass as she dey twerk am with her fat toto wey hang between her legs. I kneel down ontop the bed, position myself behind her hold her hips like say I wan pray to her toto, she quickly pour spit for her palms take am rub my penis before she finally push my iron hard preek inside her flooded pussy.

As I enter Nancy honey pot I remember the anonymous person, even though I don conclude say na Nancy be the person, I say if anybody show up now come say she be the person she sef go follow cum.

For now I say make I fuck Nancy well well till she go use her mouth confess say na she dey disturb me afterall until then nobody don call and nobody still don come.

As e dey always be with me and Nancy, na no mercy fuck we dey always fuck, as I enter naso I begin pound her in and out, Nancy wey no dey waste time to shout, she don already begin shout “ahhh” “woosh” “God” “Jesus” “yes” “fuck” full the whole house. That one no even concern me.

I increase speed small small until I begin pound her at full speed until e be like say I dey do three thrust per second, this girl take shout full my ear, see me wey never chop I begin wonder where all that strength to fuck like that come from.

Aswear toto get spiritual power. Wetin I like pass with Nancy na how she dey take jam her nyansh for my body, e get as she dey whine her waist to collect my preek as I dey bang her, wey her nyansh cheeks dey slap my body back.

Make I no even talk about how her nyansh dey bounce like say dem pump am air.

I hold her breasts firm as I begin penetrate her with full deep thrust with enough speed, this time she just dey scream my name dey beg me say make I no stop, next thing she begin say she wan piss, me wey be experienced fuckmando I know say no be piss, I no even stop I just dey knack her toto dey go.

My whole body begin totori me and I know say I go soon release but na Nancy dey sweet me pass, she dey cry still dey beg me to go faster say make I no stop, obedient guy like me I continue fast dey wipe her pussy better fuck until I finally explode!

If you see as my whole body bin dey shake as I shoot my cum inside her, as I dey spurt my load naso I dey chook my penis deeper, na then I know say no be only me don reach bus stop.

She sef don dey reach orgasm na just small workings remain to take her to her promised land. shaperly I quickly take my finger go under her, find her clitoris fast fast, I begin dey rub am, dey tease am fast, she just dey moan abi na cry or na laugh I no even understand the kind sound she bin dey make.

Until the thing pour like waterfall from her pussy, as e dey pour naso she dey laugh dey jerk wey her whole body dey tremble.

Aswear e remind me of the time wey Gloria squirt ontop my bed. After that first round, na me still finally make the eba, warm the soup, we chop finish, fuck like four times again the whole night.

Na after the fourth round 3am wey I remember my phone, I pick am only to see message wey the anonymous person don send say make I no go work that morning if I no want make she tell the whole congregation say I fuck mummy church inside her office for church.

I look the time the message enter my phone, na one of the time I dey sure say me and Nancy dey fuck. Definitely no be Nancy send that message, infact she never even comot her phone from her bag since she come my place, na just fuck and chop we dey do.

I look Nancy she dey bed dey sleep innocently, aswear I just weak— who be this person?, I no fit wait make morning reach well make I see the person.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 5767 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics