September 18, 2024


YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 5) [18+]

 

Home » YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 5) [18+]

YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 5) [18+]

E take me almost one full hour to calm Gloria make she stop to dey cry, naso I just dey beg her dey ask wetin happen, she no gree talk, wetin pain me pass be say I bin wan go another round again, and her cry no give me liver to try anything— how person go fuck better fuck finish come begin dey cry like say dem forget preek for her body.

Nothing I no do make she stop wey she gree, Gloria just use cry full the whole room. Na when e be like say she don belleful for cry and water don finish for her body she come calm down tell me say she dey serious relationship and she dey feel guilty say she dey cheat on the guy, because the guy na very nice guy and dem dey plan marry soon.

Aswear as she talk finish, remain small I for hiss for the kind yeye talk wey Gloria talk. Why she no remember that wan when she dey ride my penis like okada or when I dey make her see heaven.

As a coded guy man wey I be, I play along tell her say me sef I love her too as her boyfriend take love her and as e be, I even love her pass the love wey her bobo get for her. I use sweet mouth wash her head finish, say if I no love her e no get wetin I go dey do with her afterall Nancy get everything and she dey do me well too.

Gloria sef confirm come reason am say maybe she dey too emotional, she even apologize for the cry wey she cry because she know say the thing go don make me uncomfortable. aswear till today I still dey wonder how Gloria take fall for my mumu talk, infact na one reason why I dey fear women.

All that time as I dey console her, naso my penis just dey rise again, by the time I do all my talking finish the thing don stand strong already.

See Gloria wey dey cry o, as I pull her closer make she gum my body, dey palm her hair gently, she kiss me, her lips soft come wet well, I use my finger trace from the middle of her breast down to her flat stomach still go down until I reach the flesh between her thighs, she adjust open her thighs small make she create room for me.

I tickle her toto opening small, she don wet yokoto. Gloria own fingers too no rest, she just dey explore my erect penis and balls and my body charge up as she dey play with my danger zone. She break the kiss begin lick from my chest down to my stomach I just kneel down for the bed dey stroke her hair.

She lick my body down until she reach my penis wey don hard like iron rod, she lick the tip of my preek, use her tongue dey circle all over the tip of my penis, I just dey wonder how I fit make her breakup with her serious boyfriend make I dey fuck her alone.

When Gloria finally put the head of my penis inside her mouth, my body shake, the thing sweet me ehnn, she begin dey run her tongue up and down, I squeeze her right breast dey tweak her nipples until the thing hard like small stone. I know say the thing I dey do with her breasts dey distract her because she no come dey consistent with the blowjob.

Me sef I never ready to cum so I position her make she lie down for bed back, I begin dey kiss her from her cleavage down to her belle, to her thighs her body just dey vibrate dey shake.

I think am to give Gloria head but omo e get as my body do me, I say make I no go chook head for where I no sabi o. I use another method pleasure am, I first open her leg well well, kneel for her front, come begin use my penis dey massage her vagina, dey slide am up and down still dey use my finger dey tease her clitoris.

Na one one porn video I watch this style and the thing go well with the woman for the video. I do that one small before I begin dey tap her clitoris with my preek, this one enter Gloria head, she use one hand dey rub her pussy entrance take the other hand dey fold the bedsheet. I comot the hand wey she dey use rub her toto as the thing bin dey disturb my tapping.

Gloria just dey make sound like person wey chop hot pepper, dey sway her head left and right, if not for say na bed we dey, person go think say na demon enter her with the way she roll her eyes finish. Me sef happy say the thing dey work on her, small time she assist me hold my dick dey use am rub her clitoris fast, as I dey rub her pussy naso e dey wet, e reach when pussy juice sef begin leak comot.

Gloria blow air for her mouth like say she wan give up, she press her nyansh for bed, small time she raise her hip up, I no even know the one wey she wan do, me I just resume dey tap her clit, as the whole area don over wet, the tapping come dey sound like say person dey clap wet hand. Even though my penis bin already dey pain me but as how I see as the thing dey craze her for body, e motivate me to dey continue.

E even get when Gloria begin dey scratch her hair like say something dey do her, na then me sef confirm say I don win, she come dey beg me make i tap am faster, make I no stop, she dey whisper am small small. She take her finger support my preek dey tap herself too.

The thing be say even me too come dey feel like say I go soon spill my milk but that wan no stop me, I say make I see the end of this thing wey dey do Gloria. Small time, like say anointing catch am, Gloria begin jerk, as she dey jerk naso water begin gush comot from her pussy waaaa with force like say dem open tap leave am. E remind me of when moses for bible strike rock with eim rod and water comot.

As the water dey pour naso she dey jerk dey sound like puppy, me I don already dive carry mysef and my preek go one corner make she no use her toto water baff me, I just dey watch as she dey rub her toto with speed like dj wey dey scratch turntable and as she dey do am more water dey come out. I don see plenty girls squirt but omo Gloria own na 20 liters.

By the time the thing stop, shame no gree her look me, she carry her palms cover her face— the whole bed don already soak like say dem pour one gallon of water ontop the bed. I shift come meet her, position myself between her legs, raise her knees make e face up, her toto don swell fine like say the water wash am clean.

I drive my dick inside her wet warm pussy, the thing just enter free, she receive am like say nothing happen as everywhere don already water water dey slippery. I begin enter dey comot slow slow, Gloria just bite her lower lips dey play with her hair. I drag one pillow set am under her nyansh, she sef raise her nyansh up make I position the pillow well.

As I enter her pussy again, I confirm am say my preek reach down down this time, na then I hold her hips begin fire her pussy fast, as I dey ram her I notice say she dey try talk something but as I dey jam her the words dey break dey cut.

E take small time before I understand say she dey beg me to go harder, I say shuuu…. Vex full my body, I start to dey fuck am very fast with my last strength, I no even mercy for her toto, I know say I go soon burst but I no bother, I just dey wipe her fast, Gloria sef increase her ringtone dey shout full the whole room.

She carry hand cover her mouth but small small sound still dey leak out from her mouth as she just open eyes wide dey look me.

As I reach my busstop I quickly comot my penis from her punani, shoot am ontop her belle, Gloria use speed drag my preek chook am back inside her toto…. For my mind I say heeiiiii this girl wan get belle abi which kind rough play be this one. That time I no fit stop myself, I just obey her, release everything inside her since na she dey in charge.

Gloria raise her hips up jam my waist well make she collect everything finish. She begin whine her waist dey circle am one kind way wey sweet me ehnn, small small she come ease hersef comot her body from my preek. I still kneel down ontop the bed say make I rest small, na eim Gloria climb ontop me sit ontop my preek wey don already shrink, wrap her arms around my neck……. for my head I say again!!!

This girl go use fuck wound me. She begin whine her nyansh ontop my preek dey move front and back slowly, i first suck her whole left breast before I focus on the nipple dey pleasure am with my tongue. E no take long as she dey whime her nyansh wey my penis begin hard but the kind pain wey follow this particular erection no be here, my whole penis just dey pain me, something wey never even hard reach 50 percent Gloria just raise nyansh use her hand slip my penis inside her pussy.

Her pussy wet kpa because as she dey whine ontop me naso her juice mixed with my cum bin dey leak from her toto dey drop for my thighs.

As she balance hersef ontop my dick, she begin bounce ontop me— for my mind I say this girl wan cheat on her bobo completely make she know say she enjoy the cheating.

Her breasts just dey fly as she dey bounce ontop me, I try grab one put for my mouth but the sweetness of her toto and the pain I dey feel for my penis no even gree me concentrate. I free the breasts make e continue dey fly, my whole body don weak finish but I no know why I no stop Gloria. She bend her head down small me I raise my head to meet her lips we begin kiss as she still dey bounce dey make one kind sound.

Na then I hear the knock for door, I say make I take am escape from this her marathon fuck before she kill me, Gloria hold me tight wrap her hand around my back come still intensify the bouncing. I no fit keep up with her pace and the kissing so I break the kiss begin dey bite her nipple, e be like say that one drive her more.

Na my penis I pity pass, the thing don over work, and na my mumu pride cause am because I dey form say I no be weak man wey go back out. Gloria squeeze me tight come increase her bouncing speed wey me sef begin find air to breathe, her body begin shake, another orgasm!!!

Omo this one hold her well because the kind scream wey she scream as she dey convulse for my body, me sef gba say I don finish work for this girl.

The person wey dey for door still dey knock, the person sabi say I dey inside na why the person dey knock with force.

As Gloria weak after she climax omo I shaparly disengage from her before she go change mind say she wan start another round. She just throway herself for bed carry bedsheet cover her body. When my legs touch ground wey I take the first step, e be me like say everywhere dey turn, remain small I for fall one kind nonsense fall embarrass my generation. I hold myself, rush wear my knicker comot from the room.

Na when I reach parlour I check time see say na few minutes to 8pm. Shuuu so we dey inside dey fuck for almost 3hours, plus all the time wey she bin dey cry wey I dey beg her.

My mind tell me say e fit be Mama Chidi wey dey knock, I just prepare my mind say I go discharge her immediately make she go fuck her husband. Na as I reach the door look through the peep hole shock hold me finish na Nancy I see for the other side of the door.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 5153 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics