September 16, 2024


YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 2) [18+]

 

Home » YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 2) [18+]

YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 2) [18+]

The moment I sight Nancy the first day I go that fellowship, she enter my eye straight, even my guy wey I follow go the prayer ministry tell me say Nancy na very bad girl, but say na coded she dey run. If you sef see as God take complete work for Nancy body you go comot cap. Nancy get one kind hot body wey fit make person preek stand anytime. 

I look her that first Sunday wey I attend service sotey e get where I position myself the following Sunday so that I go fit get full view of Nancy. I just dey look her big breast wey be like something wey dem pump, infact that second Sunday wey I go there, na Nancy breast I go worship because I no even hear anything wey pastor talk. 

My eyes gum for her body, throughout service. Nancy sef notice say I dey chop her with eyes, she come dey vibrate as she dey kabash make her breast dey bounce, if I look her small I go imagine small, come pray for forgiveness.

Mehn Nancy nyansh fat and e full her back mount well like storey building. If not for say na church we dey aswear I for go press her nyansh to confirm if na real or na pad, make anything wey wan happen make e happen. 

Since that day I no dey miss service and I dey always watch Nancy ikebe as e dey shake when she dey waka. I no need make anybody tell me say her ass go soft die, my eyes don confirm am with the way e dey shake.

E get one time wey dem organize one kind get together for church, dem arrange all of us put for different group, naso dem share me put for group where Nancy dey, if you see as I just dey happy say I don see reason to dey close to her. 

Nothing I no try to get Nancy attention, the girl just dey form hard girl, she no even look my face upon say na me dey bring money pass for the group wey we dey, and as the popular local MC for town wey I be, na me dey host most of our church event, na like that I become small celeb for church. 

Na during one of our group meeting I jam sister Gloria one fine sharp church girl, that one give me face and we vibe well, but I just maintain myself onto say na brother sister things.

Gloria sef set well but she no reach Nancy, but she be me like all this ladies wey dey carry church for head, everytime I try invite her over she dey always tell me of one church meeting or one church outing she get to attend. 

As dem say person wey dey faithful for small thing go dey faithful for plenty things, I say make I manage the one wey come my way, that time I no know say Gloria na agba baddie.

For the group wey we dey, all of us for our group contribute money com appoint Gloria and Nancy say na dem go arrange all the things wey our group go present for the get together, me I volunteer my house say make dem come fry the chin-chin and peanut for my house, make I take am get Nancy. 

That afternoon wey Gloria and Nancy come, as the two of dem first enter my apartment, I know say dem gba for my package, dem confirm say I be big boy. Even as dem enter my kitchen, I notice as two of dem exchange look, but Nancy no too show her own, na Gloria just dey shake body, dey spread herself around me. Na that moment e sure me say I go fuck Gloria one day if I apply pressure.

E get when Nancy come tell me for parlor say she wan quickly comot go run something say she dey come back. E come remain only me and Gloria for house. See food wey dey hungry me since na eim dem come keep alone with me for my kitchen. 

Omo I no even waste time atall as soon as Nancy comot, I waka go kitchen go meet Gloria, I first dey for door look her finish. She wear one body tight armless gown like that wey no reach her knee, her ikebe curve well and her breast just point dey mind eim business. 

Gloria sef get one kind troublesome nyansh wey no gree my preek rest as I dey look her, the thing shoot out from her body for back like say e dey observe social distancing with her body.

As Gloria notice me if you see as she just dey smile like say she bin dey expect me, she say make I come take chin-chin, me wey dey shy, I say make she no worry, she no gree, naso she pack small chin-chin come meet me where I stand come wan put the chin-chin inside my mouth. 

Shyness first make me reject am but as she persist I just behave allow her make she put the thing inside my mouth. As I collect am dey chew naso both of us just off dey look each other, I no even know as I take hold her head, pull her close begin dey kiss Gloria, we kiss, chop lips, lock tongue, if you see as Gloria just dey use her tongue dey finish my mouth, I confirm say the girl na expert. 

I hold her for hip tight, press her body to myself, we stand there dey kiss. Fuck! Gloria sabi kiss French kiss die. As she no too tall naso she stretch her leg to reach my mouth. Me I grab her nyansh up make I support her, she sef wrap her hand round my neck dey pull my head down make our mouth touch well.

I take style dey comot the hand of her gown, see me wey dey do am small small, Gloria just slide her hand comot pull the gown viam, na eim me sef shift the gown down to her belle, I look down fast to see her bress, omo the thing full bra, I rush unhook her bra, her breast just pop out as I unhook the last strap like wetin dem free from captivity. 

Gloria breasts big no be here, na bra she take fold am — I know say I no get time to admire anything because Nancy fit return anytime as she no even carry her phone comot. I just palm Gloria breasts dey fondle am jeje still dey kiss her soft kpomo lips, Gloria melt for my body dey sound like old fridge.

The thing enter her body well when I pinch her nipple, dey play with the whole big breast, I squeeze am gently like say I dey squeeze orange, small time I bend small raise her left bress up begin use my tongue tease that one dey suck am, her body just dey vibrate, even her leg bin dey shake like say she wan fall, me I take hand support her for back make she no go fall knack head for tiles. 

Gloria com hold my preek tight for knicker wey I wear, me wey don go room comot boxers before I enter kitchen. She look me smile because e com be like say na my dick she dey hold, the knicker material dey very soft. I quickly fold the gown up hold her nyansh like say I no want make e fall comot, Gloria use one hand dey comot her pant with speed, the other hand still hold my cock like say na she get am.

I first wait make she comot the pant finish before I raise one of her leg up hang am for my hand, then I chook one finger inside her kpekus. 

Omo everywhere hot, the thing sweet me, I put another finger join the first one, the way her whole body shake like say she enter anointing come make one sound like moto wey fail brake. 

As I dey suck her bress na so I dey rub her clitoris, the thing just dey produce juice like factory, Gloria sef comot my penis, she look down look my preek, as I take look her breast when I comot her gown, me I know say I get huge dick so I no fear and the thing don hard well well, she smile as she take finger rub the tip small before she begin stroke am gently.

When Gloria begin do like say she wan climb me, bad guy wey I be I shaperly understand the kind style wey she want make we fuck, as I raise am up she quickly wrap her leg around my waist rest one hand for the kitchen table wey dey behind us, before she take her hand guide my dick enter her wet pussy. 

The moment my penis enter her punani waaammmm na eim person begin knock the main door, I wan mad.

At first I pretend like say I no hear the knock I do the first thrusting, the thing sweet me reach brain, until I remember say e be like say I no remember lock door after Nancy comot, if you see speed I use withdraw my preek from Gloria hot toto, she sef climb down from my body rush pick her bra begin dress up, I take time adjust my dick, dress my cloth and hair before I go parlor go open door see say na Nancy.

Before Nancy waka reach kitchen, Gloria don wear her cloth, tidy everywhere, dey fry her peanut and chin-chin innocently. Me sef I shock. I just leave both of dem for kitchen waka go parlor dey swear for Nancy for the break in transmission of my fuck.

I fit swear say Nancy sabi say something happen, the way she just dey look everywhere, dey look my face and Gloria face, my face wey she no gree look since. 

Besides why she no go suspect when Gloria no fry anything join the one wey dem don fry since she comot, for my mind I say that one na her business she don already spoil my knack.

Body no gree me, my whole body just dey do jigijigi as I dey parlour dey look television, serious vex full me, see as this Nancy just spoil better fuck for me wey I for fuck Gloria, if to say I know I for don run am quick and I know say even Gloria sef no go dey alright.

As I no fit hold mysef again I leave dem comot go buy food and drink wey I go take entertain them when Dey finish. But e get wetin I notice as dem dey kitchen dey work when I go gist with dem, e get the kind way Nancy just change come begin dey give me one kind green light, e even get time wey she cut eye give me, I do like say I no notice am. 

Another time wey I stand for the kitchen door, this girl pass come carry her mighty nyansh brush my preek, she no even tell me make I excuse her or anything, she just squeeze hersef rub her nyansh for my middle leg. Aswear the werey thing stand immediately.

Even as we dey gist, Nancy just dey talk bad bad things wey burst my head, she just dey different from the Nancy wey I sabi wey dey always form for me, dey give me quiet attitude, for my mind I come dey fear weda she hide somewhere see me and Gloria as we dey make out because all this sudden change no too clear me. 

Gloria sef notice, she just dey quiet dey observe as Nancy dey throw hersef on me and I know say e go dey pain am.

The two of dem dey with me until almost 8 pm for night before them begin go, I even see dem off reach junction where dem enter keke comot. 

As I enter house back, I just dey vex for the half fuck wey I no complete, I reason am to call Gloria to come back, my mind say make I leave am she fit still dey with Nancy and I no wan cast myself, afterall we arrange say one of dem go come the following morning join me carry the chin-chin and peanuts go church. 

I pray say make e be Gloria wey go come make we fornicate small before we go church, atleast when we reach church all man go pray for forgiveness. 

I think of Nancy, I no too understand that girl agenda because small waka wey she do come back the next thing she begin give me lead, I surprise o, but anyhow e be I tell myself say if she give me toto me I go fuck o.

Wetin sweet me pass na say atleast e don sure for me say I go still fuck Gloria as I don put preek inside her puna, and as e be I fit fuck Nancy too. 

Na all this things I dey think when person knock door. Na only one person fit come find me by this time for night, Mama Chidi my neighbor wife wey I dey fuck.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 7104 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics