My head full that period, say I no run mad na only me sabi how I take survive dey manage myself. No be say I no fit marry Gloria o, infact she fine well well, get sharp body and she sabi do woman things but wetin vex me then na why she use belle set me up like that still get mind carry the matter go tell pastor say she get belle for me.
The one wey annoy me pass na say pastor summon me come dey threaten me with backseat for church. See pastor wey I get eim sextape with aunt rose full for my phone.
Na then the whole gist come out say the man wey broke up with Gloria wan marry my own Nancy.
You see women, fear them o! how the matter take happen I no know, see me wey dey fear for how Nancy go react if she hear say Gloria get belle for me, I no know say the travel wey she travel tell me say she dey go write exam for school say she carry her man go her place wey dem go pay her brideprice.
When everything clear me, na me come be like mumu for the middle. She no even bother say I give Gloria belle sef, she just call me one afternoon beg me say make I forgive her say she know say I never ready and say the man don ready na why she follow the man, say make I dey with Gloria.
The thing shock me the way she just dey talk am casually like say na normal thing, I tell her say but the person wey she dey marry na Gloria man.
She no even send me for that talk, she say the man no too like Gloria, say the man talk say na she eim find come our church and na when she no too give am face eim come follow Gloria.
Me sef remember say na exactly wetin happen for my matter with Nancy too, na she I first like but as she no too look my side I come settle for Gloria before she sef come later open leg for me.
Nancy even tell me say afterall me and Gloria dey fuck too, come even reference that day wey she catch me and Gloria. Na after her call that afternoon I give up on women!
Wetin pain me pass na how Nancy take use me do revenge package. I reason am say everybody dey play sense for me and e don reach time wey me sef go use my head too.
Naso I begin drop last card for everybody, I first start with my landlord, na text message I send give that one say I sabi wetin eim bin dey run with mama Chidi.
I give am better warning say make eim dey stop to dey act like pope dey worry me, for the message I tell am say I get enough evidence, and I go report am to landlord association make everywhere burst since na eim be chairman of the landlords for our estate, then I go still tell Papa Chidi too since that one dey use am do godfather.
E no reach five minutes wey I send the message wey the man call me begin talk like normal human say make i let bygone be bygone, say we are all humans and we make mistake.
The man humble kpa, even dey preach give me, the thing sweet me ehn. Next person I send message give na papa chidi, I tell am make eim calm down, come give am breakdown of eim parole with Sandra, the man no even reply me.
Na after me and landlord finish our matter and I confirm say Papa Chidi don go back to eim base na then I carry myself go back to my house but I know say I go need pack comot soon because landlord no go dey comfortable with me at all.
All that time me and Sandra dey knack like say tomorrow no day since after that first day wey we meet for that house, as I move back come my house she sef begin come my house almost everyday, we just dey fuck like say na our calling.
We nearly use fuck wound ourselves that period, and as na only me dey the whole compound when papa chidi return to eim base and mama chidi don comot go where I no bother to know.
Na from gate me and Sandra dey begin our fuck until we reach my apartment, na only she fit tell wetin my penis do her toto that time, sometimes we go dey balcony dey knack.
E no get style wey we no fuck all that period, I swear I fuck everything wey man go fuck for that girl body, especially that her big fat nyansh, I finish work for that side, me sef know say I use my penis scatter her glory.
That time I no dey gree answer anybody call, especially Gloria because I dey vex for her and pastor wife because I know wetin that one wan talk about.
Na Aunt Rose own worse pass I block that wan sef make she no see me call until one afternoon.
I dey my office dey try write one script like that, naso Aunt Rose burst enter begin para me say I no dey give her time again say I dey avoid her, she even talk about Gloria, I know that one go don turn big gist for church and me sef dey avoid church that period.
Aunt Rose just dey hala me, for my mind I say shuuuu see as person wife dey para because of another man preek.
Me sef know say true true I don avoid her since even before Gloria belle matter but she no get right to dey rake for me for my office like that, thank God say my partner wey I dey share office with no come work that day, how I for take explain give am.
I first go put recording sign outside for my door, make nobody come disturb me onto say I dey record, then I lock the door, increase the AC, still increase music for the small music player wey dey my office.
Na for where she stand dey vibrate I go meet her come hold her from behind dey squeeze her breasts dey fondle am, she throw her head back for my chest dey do am like snake for my chest, she come dey moan dey use her hand dey support my hand as I dey palm her family size breasts.
I say see person wey dey fire now now don mellow. Small contact wey my penis get with her jumbo size nyansh, na eim my preek begin rise like compatriots for national anthem.
She whine her round meaty nyansh for my penis till my penis stretch finish, she come turn face me take her hand comot my trouser and boxer together bring my erect penis out.
Aunt Rose first kneel down lick my penis small with her tongue, the thing enter my body na eim I hold her head push am well make she take my whole preek inside her mouth, she no too suck me for long she just suck me small and I know say she just want make my penis dey wet for her pussy.
I check time because I bin get afternoon news to read. I unhook her skirt, ease the zip down come fold her skirt up, na she volunteer help me comot her tight and pant together.
I position her for the edge of my partner desk make she lie with her belle for the desk but her legs still dey ground then me I position myself behind her come open her legs well.
I bin put spit for my fingers to use am rub her kpekus make the place wet but the kind wetness wey my fingers meet for her toto, fear catch me, I wonder if she get lake or pond between her legs.
One fast push, I drive my penis inside her wet toto, I begin fuck her fast from behind, I no even do say make I start slow. Wetin I fuck Aunt Rose that afternoon and the kind speed I take dey pound her if to say na so her husband dey fuck her regularly, her pussy go don wide like tray.
The only time I comot my hand from her hips na when I wan spank her fat nyansh, or when I wan use my hand grab her butt cheek make I spread am so that my penis go enter deep down.
At first she bin dey try to control her moan but omo e reach when the wild penising no go gree her, naso she begin shout full my whole office dey call my name like say she dey find me.
Thank God say the door na heavy soundproof and e better pass Pastor’s wife own. I raise her comot from the desk go lie her for the couch where we dey take afternoon nap, na for that side I do summary and conclusion.
I raise her legs up begin knack her wetin no good for fuck. I knack her sotey her legs hang for air dey shake.
She just dey shout thank you thank you dey tell me how she don miss my koboko.
By the time I finish with her, person wey enter my office dey run mouth no fit even waka, she spread herself for the couch begin sleep wey me i just drag myself go read news for studio.
The next person wey I drop checkup card for na pastor, I send am some of eim videos with Aunt Rose with message join say make eim respect eimself if eim no want make I cast eim matter.
I give am better warning say I no dey blackmail am o but make eim no carry all those eim holier than thou attitude near me.
This man ice immediately, even dey ask me wetin I want make eim do for me, me I tell am say I no want anything say make eim just mind eim business give me space. Pastor say make I no worry say eim go handle everything discreetly.
If you see as this man begin wire money enter my account like say I be offering box. At first I do like say I no want am o, but when the money just dey flow enter like say I be church project, who am I to reject blessings.
Pastor run me enough funds wey I even buy my first car still come relocate comot from Sandra papa house, move go another better house for town.
Na still pastor wey settle me and Gloria matter and we begin dey reason small small, she beg me say she wan keep the pikin come dey profess love give me, me wey know say she just use me do revenge plan but aswear I no know as e take happen but me sef come begin fall in love with her well well.
Maybe na when reality dawn on me say she dey carry my pikin and she sef no give me chance rest, she just dey love me scatter dey do wife duties. Na that time I even come discharge Sandra, afterall Sandra too don discharge me before when she think say her yankee bobo go marry her.
The only person wey no gree for me na pastor wife— omo that woman head too strong, she begin para say why I go settle down when she never enjoy me finish I say eweee which kind enemy of progress be this one.
Even when I tell her say I don repent, say I don become born again this woman say make I keep quite say na she go determine if I be born again and when I go be born again. Laugh nearly kill me the day she talk am one afternoon wey she burst come meet me for my new apartment where me and Gloria dey stay.
I thank God say that day Gloria sef don comot go her shop where she dey do catering and decoration.
This woman no give me opportunity to choose if I want her or not, after she talk all her talk finish, she wrap her hand around my neck begin kiss me.
I bin no wan kiss her back but aswear e hard to resist mummy church kiss. I reason say i no go carry her go the room wey I dey share with Gloria so I carry her go the spare room, as we enter the room we kiss small before we begin dey drag and pull cloth comot from our body dey fling am like kite.
We climb ontop the large bed, me I jejely climb ontop her run my hand for her breasts, she respond with sound like mosquito inside my ear, before i grab her breasts firm like say I dey there when God create am begin suck am.
Na from her bress I lick her down reach her belle go down come spread her leg open, this woman clean die! as I put my tongue for her pussy the kind puppy sound she make give me go ahead say I dey the right spot.
Within two seconds her whole pussy don wet, I come dey wonder where she keep the reservoir of water. As I dey suck her pussy na so I still dey use finger dey tickle her, my other hand still dey fondle breast, she just dey turn dey press my head for her toto.
E reach when she begin shake dey talk wetin I no sabi, I chop mummy church toto well well before I migrate go her breast full time again — this time she don off patapata, come dey beg me say make I just fuck her.
I finish sucking her bress come concentrate on her neck, lick am reach her ear, she no even wait for me, she just raise her leg up, spread am wide chook my penis inside her wet juicy pussy, the feeling I feel when the thing enter ehnn, I swear even if you shoot me that time I fit no feel am.
I start to dey fuck her toto slow like say I no sabi wetin I dey do, na she grab my waist dey jam am to her body with force, I just dey keep my cool pace.
By the time I match accelerator begin thrust fast, I fit bet am say people wey dey pass for road hear the loud sound she make.
I fuck this woman with vex and passion make she no disturb me again, as I feel am say I wan release I pull my penis out, shoot my load for her belle, immediately after the last spurt I chook my preek back inside her pussy continue dey fuck her, even my dick sef gba say oga dey vex.
After sometime I grab her waist turn her make she lie with her chest for the bed, her nyansh come raise up like 2 storey building, I kneel behind her like say I wan pray to her nyansh begin fuck her confirm doggy, the pampampampam sound of my groin as e dey slam her nyansh reach make person think say carpenter dey work for the house, she just dey make noise dey speak Spanish.
After many minutes she begin shake, me sef don dey feel say my end dey come again, naso I intensify the speed and deepness of my stroke, Mummy church grab the pillow like say she wan tear am come dey make one animal sound as her orgasm flow ontop my dick inside her pussy, na that turn me wey me sef begin shoot my own again this time straight inside her.
After we finish she tell me say make I promise her say even if I settle down with Gloria I go still dey get time for her, omo me I no gree promise that kind thing because I no plan to cheat on my woman for any reason and besides I don tie her husband finish and anything wey make the man find out say I dey scrub eim wife, I no sure say I go fit save myself from wetin that man go do me.
I just take talk jonze her but she promise say she go dey fund me steady.
E no too tey I go do something ontop Gloria head, I don love her die, wey me sef no believe say I fit love person like this.
I hear say mama chidi and her husband later divorce, e pain me o because I know say na me cause am, but that man head sef too strong, upon say eim sef dey fuck Sandra eim still no gree forgive eim wife.
Pastor sef later cast, dem catch am with one church choir girl like that, not even Aunt Rose. Mummy church leave pastor, I just dey look her with one eye as she enter social media dey para say she no fit dey with man wey dey cheat.
See woman wey put me on payroll make I dey fuck her atleast two times every week.
I get plans say as soon as Gloria born our baby and I marry Gloria I go officially end everything with any other woman or girl wey dey my life.
That time I no know say marriage na just the end of a new beginning.
End of Part 1
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 175 times!