September 16, 2024


YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 1) [18+]

 

Home » YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 1) [18+]

YeyeGist: Bodycount Memoirs (Chapter 1) [18+]

I bin get one sure gig that night to anchor one event for one sharp hotel wey open new for town, but the heavy rain wey fall that evening nearly scatter my shine.

Na one of those things upcoming entertainers like me dey suffer for this industry, but all this event organizers no dey ever gree say dem dey cheat us, dem go expect us to come perform heaven and earth ontop the small chicken change dem go pay wey no fit even buy one bottle of better wine. If not for the passion wey I get for this MC thing ehnn, God know say I for don free am go find another hustle. 

The rain that evening heavy no be small, and I know say if I put head inside I go soak finish before I reach junction to enter keke. I no fit even afford to enter Uber, how much dem pay me for the show wey I go use Uber and me i no fit risk am go late because na me be the main MC for the event.

if no be say I get event na this kind time I dey like call Gloria, one sister like that for my fellowship wey I bin dey scrub that time, na as Gloria sabi pray na so she sabi fuck, the same energy she dey use speak in tongues naso she dey speak foreign language if I dey lash her, Gloria na one kind bad God-fearing lady wey I no dey carry play atall. 

No be only Gloria dey turn up for me for this kind time, Na this type of weather Mama chidi dey like sneak enter my apartment……. No worry I go still gist una how I take begin chook my penis inside my neighbor wife. 

Mama chidi too like fuck and no be like say she sabi move body or do anything o, she just like make preek dey her body, she go just lie down yakata for bed if we dey kpansh, dey sound like person wey get breathing problem. Na me dey do the whole work, and her toto wide no be here, upon say my preek get meat come long join e no dey ever fill her pussy. Me I just dey use her cure urgent conji.

  Omo I dey my room dey reason am until I conclude say if I no find way begin waka under this rain I go fuck up. I put the main cloth and shoe wey I wan wear for the event inside bag, carry my umbrella onto say if I reach the venue I go change, wear the cloth wey dey for bag. Na so I chook head enter the rain dey find keke. 

E come be like say the rain take am personal dey beat me like say na me be the main target,  e get as the rain heavy I begin fear if everybody don leave me enter Noah ark. I just dey put leg inside potopoto water dey waka, the umbrella no even cover anything, me and my umbrella just dey struggle because the kind strong breeze wey bin dey blow nearly fold the umbrella comot from my hand. 

No be like say I no later see keke o, but nobody wan go that side wey I dey go, dem say water dey always full the road and the water go spoil their keke.

E get as the rain beat me reach I no see road again, na that time I begin find shade to hide before I go fall inside gutter, finally i see one wey I rush enter but omo the place no go well atall, the rain still bin dey beat me well well for where I stand e get one lady wey I meet for there too. 

I no too see her face but I see say she sef don wet small but her wetness no reach my own, I just dey think about the event, I check time I don already dey 30minutes late, I think of my cloth inside the bag, I know say the cloth go don wet small. I don already tell God say if I no fit buy car this year make I kukuma find another thing dey worship. 

Small time the rain reduce but I say make I still dey cool body small, the lady run comot from the shade, as she enter road, motor wey dey pass shine light for her body, bruh!!! see sexiness as the rain don wet her finish, her breast just stand gbim for the gown wey don soak gum her body come bring out her nyansh curve well. For my head I say kai na wetin person suppose dey use hold body for this kind cold. As I see say the rain don come down true true na so me sef put head begin run dey look if I go see keke this time.

Aswear I no know who blow whistle but na as I comot from the shade enter main road waka small, the rain start again begin fall heavy even pass the first time like say na me be the target, I say which kind juju be this one. 

This particular rain beat me ehnn because I no see anywhere to hide this time until I begin dey hear shout like say person dey call me, I look everywhere I no see anybody, I wan continue dey run before I see phone light dey wave around one dark shade like that, me I just run enter the place I no even reason am say e fit be all this bad boys because na so dem dey operate for rain, me I just wan comot from rain.

The corner dark well well but e cover well too, na when I reach the place I come look see say na that lady wey bin dey the other shade. The rain sef don beat her again, I thank her, come drop my bag ontop one large table wey dey the place before I begin squeeze water comot from my shirt, I later open my bag I see say the cloth don wet but e no too wet sha. 

I comot my phone see missed calls from the event organizer, I even see say Mama Chidi sef don call me. kai the woman dey find penis. I text the show organizer shap shap say na rain hold me, the man reply me immediately say dem don push the event enter club as the rain no go gree dem do the event for open space and say people sef never turn up because of the rain so dey never start. 

For my mind I say thank God o, because me I no fit refund anybody.

I look the lady, she just fold hersef stand for one corner dey press her phone, I remember the kind hot shape wey I see that time wey motor flash light for her body, I say make I do good guy since she help me. 

I comot the thick leather jacket from my bag wey I bin plan to wear for the event, carry am go give her make she wear, the lady first reject am say wetin I go wear but I insist say make she collect am say me I go manage. 

That time cold don enter my body finish but I still dey form Mr romantic because as the rain dey fall na so breeze just dey blow cold enter person.

From there we begin gist, she say na her friend wey she dey gist with delay her if not she for don reach house tey tey, me too tell her about the event wey I suppose host, she even sabi the hotel. 

E reach when she notice say cold wan finish me, she come say make I collect the jacket make I use am warm body too. Mumu me still dey form hard man, I reject am, she even use am yab me say make I no form good guy die till cold kill me o, both of us burst laugh.

Next thing she say make I hug her say the cold go reduce for my body if I hug her, I first pretend like say I no hear her until she talk am again, I just dey do sme sme dey do like person wey dem tell to off pant, till she hold my hand pull me to hersef na so we hug. 

E get as she take use the jacket wrap me inside her as we hug I just dey feel her whole cold breast for my chest, we remain like that until my preek begin grow inside the joggers wey I wear, I know say she feel my penis for her thigh, na then she off me, this lady  begin use her knee rub my penis, my body do grrriiiiiiii like say person ring bell inside me but I still maintain.

When she finally free me I think say she wan go, I no know say na start she start, until this girl grab my dick remain small I vanish with fear and shock, I just dey inside darkness dey look, she hold am dey laugh wan kind ashawo laugh inside my ear, dey stroke my dick small small come pull my face down begin kiss me, me sef return the kiss back. 

If you see as her lips soft, e get when the kiss intense enter body wey both of us no even see air breathe well, I fold her gown up raise one of her leg up to inspect her puna, I notice say she wear tight, as I wan give up the girl begin use speed comot the tight with one hand. Na when I grab her nyansh I notice say she comot pant join, fast fast before she go change mind, my finger slide enter her pussy, if you see as the whole place water water, you go think say na there the whole rain water enter.

I no even mind say person wey dey also run from rain fit join us or anything fit happen, nothing dey my head that moment, only my heart wey bin dey run relay race, I tell mysef bro calm down you don fuck this one for road. 

She comot her tight and pant kpatakpata fling am ontop the big wide table wey I bin drop my bag. If you see force she use drag my joggers and boxers down together like say na fight, before she turn her back give me. 

For my head I say “oh we begin with doggy” I hold her bress firm from behind.

The way this girl bend hold the table still open her leg, I tell myself say this girl no be jjc for this ministry, as I put my penis inside her pussy from behind, the thing enter wololo like say the two na follow come. 

As I begin dey fuck her from behind I just dey wonder how the whole thing take happen, one minute I dey under rain the next minute I dey fuck a total stranger. Inside that cold weather, this girl punani hot come wide gan, the accuracy wey she use her nyansh dey jam my prick I know say I don fuck ashawo without condom, na the vex of say I don fuck up I use apply pressure dey go very fast say make I confuse the infection wey she fit carry and even if I carry something make e be say I knack her well enjoy the knack.

I use one hand pull her braid back take the second hand hold her bress dey smash her small portable nyansh, she sef take one hand hold the table, take the other hand hold my leg, I no even know if she bin dey push me or pull me closer. 

E get as she take raise her leg small e be like say my whole preek fall enter her market square that time son of man lose control, I release hot sperm inside her. The way she take push me say why I release inside her, I bin think say she go use vex end everything, for where? She pull me with her go rest her back for wall, me I just dey follow her like person wey dem don swear for. We begin another round of kissing, I raise her leg up hang am for my hand then bend small make my preek enter her pussy.

We do that position for few minutes because that style no too go well with me. next thing this girl get mind climb the innocent table wey the owner of the shop go still display goods ontop the following day, but that wan no stop me o, me sef climb the large table join am. 

I align myself well, raise her girl leg up still wide am begin lash her punani, toto wey still wet like river Euphrates, I fuck that girl like say na she send rain to beat me. she sef just dey pinch me, press my head, squeeze my shoulder, twist my ear. When she grab my nyansh dey control my movement fast fast, I confirm am say she don enter point of no return.

This time as I wan release I quickly pull out pour the thing for her tighs, the girl just weak ontop the table take her hand cover her face. 

I climb down from the table victoriously like one gladiator wey win arena battle begin wear my cloth, my body just dey sweet me as I notice as she take weak, I just take corner eye dey observe her as she use her pant and tight wipe her pussy still clean sperm comot from her laps before she put am inside her bag. 

For my head I say as she dey like that she no wear anything under her cloth. We just dey do like  strangers nobody gree talk first, afterall we be strangers before fuck connect us. When she arrange hersef finish, she return my jacket give me.

This time the rain don already clear small, she hug me kiss me I take hand press her small soft nyansh, I know say she no wear anything my penis begin stand again although this time I no go lie e get as the thing bin dey pain me already. 

Omo this girl turn again drag her gown up begin use nyansh rub my preek. I say shuuu!!! upon all the fuck wey I nearly use tear this girl toto she no tire. This one na first class fuck attendant, me sef comot preek push am inside her toto I no even send if e wet or dry, but the thing wet small. 

This time I bang this girl like say na there my success go come from. I knack her sotey the table wey she hold begin shift with her I no even mind I dey follow she and the table dey smash her nyansh.

E get when she begin use hand dey push me to stop, I no send am, me wey wan explode inside her. aswear till today I no fit describe the feeling I feel that night when I finally release, my body sweet me ehnn. When we finish she just weak kneel down for ground because her leg no fit even hold her again. 

I try raise her up but she shove my hand comot. Small time she just get up, adjust her gown carry her bag wan begin go, I ask her for her phone number she no gree. If you see as I take dey follow this girl for back that night dey beg her for her number for road, she no gree give me until she enter keke go, na then I realize say I no even sabi her name.

After that day I begin find this girl everywhere, naso I dey shine eye if I dey waka for road like arm robber dey look everybody face, I dey always wonder why she no gree give me her number, if na because of the kind merciless fuck wey I knack am or na shame dey catch her. Before I tell you how I take find that girl until we jam again, make I gist una about my matter with Gloria and Mama Chidi.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 8969 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics