I rush the last bottle of beer, na my third bottle that night and normally 3 bottles na my gauge, infact I never even finish the third bottle wey my eyes sef don begin dey turn me small small, but I just maintain composure.
I never ready to go house, because I know say if I go house Ubi go dey wait for me, that my landlord pikin no sabi anything pass fuck, and no be like say she sabi fuck o, wetin dey pain me pass be say she go just lie down yakata make I dey do the whole work like say na me invent fuck, she no dey even try give me joy, if I ask for blowjob na then she go begin quote book of matthew and titus give me, yet we dey fornicate everyday.
Na why I like Chidera that one dey handle my preek like say na lost but found treasure, she dey suck me kpa.
I take style look the lady side where she sit down for the joint, she still dey there, fine confirm sharp babe like that, I check time na already 10pm, and she still dey alone. Immediately I enter the bar that evening na she I first sight and na since then I don pin my eyes for her side dey mark her.
I say make I gather morale go follow am talk, atleast if na transport be her problem or maybe she wan make call I fit help her based on one or two, even if my kindness no land me her pussy that day e go set for me another day.
As gentleman wey I be I waka go approach her. she open up tell me say she just enter town say her phone battery bin dey down and even as she don charge am, the person wey she wan meet sef number no dey go through. Just small talk wey we start, we begin gist dey relate like say we don sabi each other since.
E come be say she from warri and me sef bin do my NYSC for warri so naso we just dey flow dey talk till 11pm when e reach time wey the joint wan close.
She call the number again the number no go through, I look around na just the bar workers wey dey prepare to lockup and the hausa security guy, that one fit chop her raw if I leave her there. na as the lady stand up follow me comot outside I come look her well well, oboy this lady gather die.
See shape and curves everywhere, her body full, tall, fair lady with wide hips, her nyansh come be double decker, two full storey buttocks inside one short blue gown wey she wear.
Her breast gan no carry last, I say tufiakwa who go invite this kind full package come dey jonze am. I conclude shaperly say I no fit leave this lady with this aboki man.
I bin no know how she go feel if I tell am say make she come my place come sleep so I first reason her hotel. The lady she no get money to lodge for hotel and honestly me sef i no get spare cash for hotel.
I first begin relate give her how the area take dangerous for night, before I come use style suggest my place.
She just accept one time say no problem, for my mind I know say with wetin I dey see me sef I no go fit sleep for night.
We take leg waka reach my place as e no too far from the joint, I help her carry her small box, she carry her hand bag, na only one aboki shop still dey open for the area, we stop there, she tell me say she no dey hungry o but I still insist buy things for tea, atleast for early morning she go drink tea before she go begin waka, I still buy one better bread join.
As we reach my compound gate, Issa the security man open gate for us, the whole compound just quiet everybody don sleep, I know say Ubi go don check me tire, we just jeje enter my apartment.
When we enter the lady bin beg me for shirt say she no go like scatter her bag, I give am one of my shirt. I tell her say I go dey parlor make she dey for room since na one room one parlour I dey stay, she no gree say both of us go sleep inside room say she no go dey comfortable inside room alone.
For my mind I say hehe, I dey run na u dey serve o. small time she go shower come back, she just wear my shirt, I swear if no be say I get good memory I for think say na another person, e come be like say she fine add, even my shirt fit her pass me, I just dey admire her tighs, as e fresh come dey shine, na then I even notice her lips the thing full come pink well well, me wey never baff for night for my life, i baff that night.
As I no get mat or extra foam I say I go dey for the cushion wey dey the room make she dey for bed, na so she begin para oo say we go dey the bed together say why I dey do like saint she even come ask if I be virgin if I never knack before, I just laff, me wey still fuck Ubi ontop that bed that same morning.
The moment I climb the bed na so my preek begin rise one kind yeye rise wey I no understand, the whole drink vanish from my eyes, the kind sleep sef no gree come, na so we continue our gist dey talk of dangerous places for warri, omo e no get anywhere wey she no sabi for warri and me sef I sabi places too.
E reach time she talk say she wan sleep say make I off light. Viaam I carry speed go off light, but aswear sleep no gree come o, dem no even born sleep well to come with the way my penis just stand gidigba like say dem call am to report for duty, na so I carry phone begin press, I know say she sef no dey sleep too, I don dey with too many ladies and I sabi their trick well.
Small time she just turn collect the phone from my hand keep am for bed side come hold me tight like say she wan enter me, na as I hold am back I take style grab her nyansh, I see say she no wear anything under the shirt, 2 seconds my penis grow reach peak.
I no waste time at all, I just go down small hold her face, locate her lips begin kiss am, ahhh her lips no disappoint me, the thing soft as I take imagine am for my head. as I kiss her naso I run my hand for her bress, she sef come begin dey respond with sound like mosquito inside my ear.
I begin fold the shirt go up make I get full access to her bress na she wey even help me comot the shirt finish. I grab her breast with authority like say na me create am begin suck am, I take time begin lick her belle go down come spread her leg open, omo this girl clean die!
As I put my tongue for her toto the kind sound she make I know say I don win 10-0, over wetness dey worry her pussy, as I dey suck her pussy na so I still dey use finger dey tickle the thing, my other hand still dey fondle breast, she just dey turn dey press my head for her toto.
E reach when she begin shake dey talk wetin I no sabi, I chop her toto well well before I migrate go her breast full time again — this time she don off patapata, dey beg me make I just fuck her.
She grab my dick inside knicker, come begin drag my knicker comot like say we dey fight, me sef help her comot the knicker, na that time I concentrate on her neck begin suck am, she just raise her leg up spread am wide chook my penis inside her wet juicy pussy, the feeling I feel when the thing enter ehnn, I swear even if you give me any amount of money at that point I no fit feel that kind joy wey full my body that moment.
I start to dey fuck her toto slow like say I no sabi wetin I dey do, na she even grab my waist dey jam am to her body with force. by the time I match accelerator increase speed I fit bet am say all my neighbours hear the noise wey she make.
I fuck this girl with vex and passion like say na my calling, as I feel am say I wan release I just pull my penis out, shoot my load for her belle, immediately after the last spurt I chook my preek back inside her pussy continue dey fuck her straight, even my dick sef gba say oga dey work.
Both of us just get matching energy, as I dey give her na so she sef dey whine waist for bed dey thrust her hip enter me. Even the sound she bin dey make follow dey motivate me to fire harder, the second time I cum inside her been dey very intense, my whole body shake like say dem tie livewire round my body.
Me sef know say na this kind fuck dey produce bouncing baby. Both of us crash for bed sleep. I no even sleep complete 2hrs when I begin feel this kind sweet sensation for my dick, omo na blowjob she take wake me, I say ahn this girl just come finish me.
I been wan pretend like say I still dey sleep but jeezzzz this girl too good, I no fit hide this one.
She no even send me she just dey suck my dick even go under suck my balls add, e get as she take lick the tip of my penis omo I nearly craze, I position her well so that I fit dey use my finger dey tease her toto, small touch wey I tease her clitoris everywhere just liquidate.
Next thing she climb ontop me come lower hersef ontop my erect penis begin ride me, I let her ride me as her huge breasts dey fly for my front, naso she sef dey bounce ontop with one kind energy.
After sometime I grab her waist turn her nyansh make e face me, begin fuck her confirm doggy, the kpakakpaka sound of my groin as e dey slam her nyansh reach to awake everybody for the compound, talk more of the noise she dey make like say she dey sing Korean song.
After some minutes both of us weak again, we collapse again sleep.
By the time I finally wake up for morning, day don already break finish, I turn look my side for bed I no see anybody na only my shirt I see for bed, fuck clear comot from my eye immediately, I first look the door, come look where she keep her box, everything still dey intact my mind cool down say maybe she go toilet. Na then e hit me, toilet how?
I remember say I bin lock door put key inside drawer before we climb bed for night. infact na so I dey always do anytime I carry any strange girl come house, especially when I carry ashawo. Person no fit trust all this jaguda girls. I open drawer check, I see the key inside the drawer as I take keep am for night.
I rush go check parlour, everywhere dey intact even the main door still dey locked, even if she open the drawer pick the room key aswear she no fit sabi where I dey hide parlour key. I check toilet, check kitchen I no see her, I carry my phone, funny thing be say I no even sabi her name talk more of her number. Na from gist I carry her come house.
One part of my mind dey tell me wetin don happen but I no wan believe say I carry ghost come my house come fuck, I even go outside go look the gate but some of my neighbors don already comot so the gate dey open, I ask Issa the security man if eim see when the lady wey I carry enter house the previous night comot.
Na that wan shock me pass, Issa say I no enter with any lady say na only me enter last night, nothing I no use describe this girl, Issa tell me say na me knock gate wey eim rush open am, only me waka enter say no girl follow me enter and I even dash am bread and tea wey I buy come. Aswear if you see as fear enter my body.
I no first believe until Issa go inside go bring the bread come show me. Issa say eim no see any lady say na only 3 people don pass gate since eim open am for morning and all of them be my neighbors.
I run back inside room go where she keep her bag, I no see the small hand bag wey she bin carry, I come drag the box from the corner wey she put am, the box no dey locked so as I drag am the thing just waaaamm open, if you see the kind money wey full the bag, clean mint naira notes, I first run go lock door…
TO BE CONTINUED
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 9222 times!